Who be di suspect wey carry out di second assassination attempt on Trump

Selfie show Ryan W. Routh in military bulletproof vest wearing red white and blue t-shirt and bandana around im neck wit wall of flags of di world behind am

Reuters

Dem don rush former President Donald Trump to safety on Sunday afta wetin di FBI call apparent assassination attempt at Trump golf course in West Palm Beach.

Di incident come almost exactly two months afta di shooting wey happun for Trump rally for Butler, Pennsylvania, wia Trump injure and one supporter die.

Details still dey come out from di latest incident and about di suspect, wey US media don name Ryan Routh. Dis na wetin we know so far.

Who be Ryan Routh?

Details on di suspect history dey slowly come out.

Speaking to US media, Mr Routh son, Oran, describe am as “loving and caring father”.

“I no know wetin happun for Florida, and I hope say dem don blow tins out of proportion, becos from di little wey I don hear, e no sound like di man I know fit do anytin crazy, much less violent,” Oran tell CNN.

BBC Verify don find social media profile matching di name. Dem indicate say Routh call for foreign fighters to go to Ukraine to battle against Russian forces.

E get pro-Palestinian, pro-Taiwan and anti-China messages on im profile, including allegations about Chinese “biological warfare” and references to di Covid-19 virus as “attack”.

Routh, wey no get any military experience, tell di New York Times in 2023 say e don travel to Ukraine immediately afta Russia invasion in 2022 to find military recruit among Afghan soldiers wey run comot from di Taliban.

E dey involved in recruitment effort, recently dis summer, writing on Facebook in July: “Soldiers, please no call me. We still dey try to get Ukraine to accept Afghan soldiers and hope to get some answers in di coming months… please get patience.”

Early reporting suggest say Routh get criminal record. According to CBS sources, Ryan Routh dey charged and convicted of plenty felony offences for Guilford County for North Carolina between 2002 and 2010.

Di offences include carrying a concealed weapon, resisting arrest by police officer, driving wit revoked licence, possession of property wey im steal and hit and run wit motor vehicle.

Watch: Ros Atkins on…di apparent Trump assassination attempt
The British Broadcasting Corporation

How dem spot di suspect?

Di incident happun for di Trump International Golf Club for West Palm Beach, about 15 minutes from Trump Florida residence, Mar-a-Lago.

Secret Service agents see di gunman, as dem dey sweep di course ahead of di former president as e dey play. Di agents usually go one hole ahead to perform security checks, according to police.

Di muzzle of di rifle – wey County Sheriff Ric Bradshaw initially describe as AK-47-style rifle – dey spotted as e show for di bush by di di course. At di time Trump dey about 300-500 yards (272-557m) away from di gunman, e tok.

One agent “immediately engage” wit di pesin holding di rifle, wey run comot, Sheriff Bradshaw tok.

“Di Secret Service do exactly wetin dem suppose do.”

Sheriff car blocks di street outside di Trump International Golf Club in West Palm Beach, Florida, on September 15, 2024 following shooting incident at former US president Donald Trump golf course.

Getty Images

How dem catch di suspect?

Agents open fire wen dem spot di gunman and fire four to five rounds of ammunition.

Di suspect drpp di rifle and run comot inside vehicle, abandoning di weapon along wit two knapsacks, scope use for aiming weapon and GoPro camera, Sheriff Bradshaw tok.

Witness see di man running from di bush to inside one black Nissan, di sheriff tok. Di witness capture foto of di car and provide am to law enforcement agents.

Police arrest di suspect around northbound on di I-95 highway afta crossing into Martin County, roughly 61km (38 miles) from Trump golf course.

Several law enforcement sources don tell BBC US partner, CBS News, say di suspect name na Ryan Wesley Routh.

Palm Beach County Sheriff PIO Teri Barber hold photographs of di rifle and oda items dem find near wia dem discover di suspect during press conference regarding di assassination attempt of former President Donald Trump on September 15, 2024, for West Palm Beach, Florida.

Getty Images
Officials show images of di suspect belongings during news conference

Source