First petrol loading start for Dangote refinery – wetin e mean for Nigerians

Di Nigerian National Petroleum Company Limited (NNPCL) on Sunday, 15 September begin dia first petrol loading from Dangote Petroleum Refinery.

Member of di Presidential Committee on di Sale of Crude oil and Refined Product, Zacch Adedeji, tok say from 1 October, di NNPCL go begin di supply of about 385kbpd of crude oil to di Dangote Refinery and na naira dem go take pay.

According to Adedeji wey also be di Chairman of di Federal Inland Revenue Service (FIRS), Dangote Refinery go supply PMS and diesel of equivalent value to di domestic market and receive naira.

“I dey glad to announce say all agreements don dey completed and loading of di first batch of PMS from di Dangote Refinery go commence on Sunday 15th September,” Adedeji tok.

Oda agreements wey di committee reach include di sale of diesel in naira by di Dangote Refinery to any interested off-taker and na only NNPC dem go sell Premium Motor Spirit (PMS) to.

Dangote refinery

BBC

Na about 300 trucks NNPCL wey belong to NNPCL bin arrive for Dangote refinery for Ibeju-Lekki area of Lagos on Saturday, 14 September ahead of di petrol loading.

Questions wey Nigerians dey ask be say wetin dis go mean for dem? E go make petrol dey more affordable or make am more available?

Petrol fit dey more available, not more affordable

Dangote refinery

BBC

Nigeria economist wey get beta experience for di Energy Sector, Dr Okey Okere, tell BBC Pidgin for interview say di major challenge na di fact say NNPCL go be di only buyer of Dangote Premium Motor Spirit (PMS), so na dem go kon dey sell to di oda oil marketers.

“Dat one go make di NNPCL anoda monopoly, and even though dem dey claim say goment hand don comot for di company, we know say e still dey for goment hand and e go still behave like goment institution wey we know through di years say dem no too dey efficient,” Dr Okere tok.

Also, e tok say infrastructure na anoda factor.

“If we go still rely on trucks to move into Lagos from Kano, from Kaura Namoda, and across di kontri, to buy fuel from Dangote refinery, and kon dey carry am back wit our bad roads, wit police collecting money for road, tiff pipo, and kidnappers, and all of dose tins wey dey happun for Nigeria roads, I no know how petroleum price fit dey significantly lower for Nigeria,” di economist tok.

“So I expect say we go see change especially for di stability of our currency, becos we no go dey run around for forex to take import fuel.

“But I no sure e go affect inflation. Inflation go still dey high for some time becos I no get confidence for di NNPC to manage di distribution of di PMS effectively and efficiently to bring down di price.”

Some facts about di Dangote refinery

Di refinery dey for Ibeju-Lekki area of Lagos and e cover a land area of approximately 2,635 hectares.

According to di Dangote Group, di facility go be di world largest Single-Train 650,000 barrels per day Petroleum Refinery with 900 KTPA Polypropylene plant.

At full capacity, e dey expected to meet 100% of Nigeria requirement of all refined products and e go get surplus for export

E dey designed to process large variety of crudes including many of African Crudes, some of di Middle Eastern Crudes and di US Light Tight Oil.

E get 177 tanks of 4.742 billion litres capacity.

According to statement from Dangote, dem use di world largest dredgers to dredge 65 million cubic meters of sand and e cost approximately €300 million.

Source