Police viral video: Ibadan lady ‘dehumanization and sexual harassment’ suspects don chop arrest and interrogation for robbery case – Official

Nigeria police don identify three officers, arrest two wey dehumanise lady for viral video.

“Following di investigate into didehumanizing treatment of one female citizen wey we see for viral video on Wednesday, 22nd July, 2020, di Nigeria Police Force don identify three (3) police officers and one (1) civilian wey follow dem participate for di unprofessional act.” Police tok-tok pesin Frank Mba release for statement.

Dem arrest two suspects ASP Tijani Olatunji and Inspector Gboyega Oyeniyi. Di statement add.

DSP Mba say dem don detain dem for di Lagos State CID detention facility for Panti, Yaba.

Im also tok say dem don intensify effort to arrest di oda two.

Di IGP bin order investigate afta di video of one woman for Ibadan, South West of di kontri, wey police dey molest, go viral.

For inside di video, dem handcuff di lady wey dem meet for di house wia dem wan go arrest one suspected armed robber.

Dem handcuff di woman wey say her name na, Towobola, record di video while dem dey question her on her sexual relationship wit di suspected robber.

Di video make pipo para for social media.