Children dey among di many pipo wey boat accident claim dia lives for Zamfara

A file photo of a boat

Getty Images
File photo of boat

About forty pipo including children dey among dose wey lose dia lives on Saturday afta one boat capsize for Gummi town, di headquarters of Gummi Local Government Area of Zamfara State.

Di Director of Emergency at the Zamfara State Emergency Management Agency (ZEMA), Hassan Dauran, wey speak wit local tori pipo Channels Television tok say di boat bin dey carry about 50 passengers wen di tragic accident happun.

According to Dauran, na only few of di passengers dem rescue alive, while di majority of di passengers, mostly women and children no fit make am alive.

One eye witness account tok say di victims bin dey go dia farms for di early hours of Saturday wen di boat capsize and sank into di river.

According to di eyewitness, na 53 farmers dey dia including children for di boat and only 12 dey rescued alive including di captain of di boat and di remaining 41 die.

Di Emir of Gummi, Justice Hassan Lawal (retired), don tok sorry to di families of dose wey lose dia lives for di incident.

E described di incident as veri tragic and pray say make Allah forgive all di pipo wey lose dia lives and give dia families di stength to beat di loss.

Di na one of di many incidents of boat accidents wey don claim lives across Nigeria in recent times.

Source