Nigeria goment no go dey pay Batch A and B N-Power beneficiaries forever

Di Nigeria goment don reply di N-Power beneficiaries wey go do rally for National assembly on Thursday 23 July say dem wan make di goment pay dem N600,000 grant each.

For statement wey di Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development release, dem tok say dia demand no be part of dia agreement wey dem bin sign with di Federal Government for 2016 and 2018 wey tok say dem go comot dem afta 2 years.

Di goment tok say not even now wey dem dey prepare to engage new beneficiaries.

Di goment add say dem no fit afford di N300 billion grant di beneficiaries bin dey ask for.

Di representatives of di beneficiaries wey go do ‘I no go gree for national assembly wan make Federal goment employ all di 500,000 beneficiaries and make dem also pay dem N600, 000 each as grant.

Federal goment tok say dem don spend hundreds of billions on N-POWER beneficiaries during di last 4 years and don dey tok wit di office of di Accountant General of di Federation, wey dey responsible to dey pay dia moni, to make sure say dem pay dos wey remain dia moni without wuruwuru.

Di Federal goment bin start di N-Power scheme for 2016 and so far dem don upskill ova 500,000 beneficiaries.