Rotimi Akeredolu don win “Ondo State Governorship Election results” for second term

Oluwarotimi Akeredolu, di current Govnors of Ondo State and candidate of All Progressives Congress don win di 10 October Govnernorship Election.

Nigeria election office, Independent National Electoral Commission (INEC) declare Akeredolu winner on Sunday just few minutes past 3 O’clock in di afternoon afta dem count final results from di 18 local goment areas of Ondo State.

With 29,2830 votes, Oluwarotimi Akeredolu party All Progressives Party beat Eyitayo Jegede of Peoples Democratic Party wey get 195,791 votes.

INEC declaration mean say Akeredolu go return to serve second straight term as govnor of di south west state.

INEC say dem go present di certificate of return on Tuesday 13 October, 2020 at 10am.

Akeredolu win Ondo Election

BBC

See di final “Ondo State Governorship Election results”

Ondo Elections Graphic

BBC
Map Key