Di only African among six odas wey wan be International Olympic Committee President

Foto of Kirsty Coventry wen she bin chair di IOC Coordination Commission for Brisbane on 2032, wia she speak to media during di Brisbane 2032 Olympic Games media update for Sofitel Hotel on May 01, 2022 in Sydney, Australia.

Getty Images
Kirsty Coventry bin chair di IOC Coordination Commission for Brisbane on 2032 media update

Di International Olympic Committee (IOC) na di highest administrative office for sports across di world.

Just as Fifa dey in charge of football for di world na so di International Olympic Committee dey in charge of any sports for di world wey be Olympic sports.

Di IOC release di list of candidates wey wan become President. Di list include seven pipo for sports.

Dis dey come afta di current President Thomas Bach bin announce for di 2024 Paris Olympics for August say im go comot from di position (seat) wen im second term end for March 2025.

Di seven ogbonge pipo for sports don line up to take over from di German Lawyer, Thomas Bach.

One of di pipo na former Zimbabwean swimmer, Kristy Coventry and six odas.

Kristy Coventry, wey be seven-time Olympic swimming medallist, dey hope to become di first woman and African to head di IOC wen Thomas Bach second term end for 2025.

Di IOC members go elect di president through a session of secret ballot.

Dem dey elect di president for one term of office of eight years, and na only one time dem go renew am for a period of four years.

Who be Kristy Coventry?

Kristy Coventry na two-time Olympic gold medallist for Zimbabwe. She bin compete for swimming events.

Dem born her on 16 September 1983. She be Zimbabwean swimmer and politician. She be di current Minister of Youth, Sport, Arts and Recreation for di Zimbawean cabinet since 2018.

She be 41 years and she get both athletic and also get experience to manage goment tins.

She be di first woman to compete for di IOC presidency afta Anita DeFrantz for 2001.

Anita wey be di first female vice president for di IOC comot for di first round of voting.

According to her official Linkedin profile, Christy Coventry na 5-time Olympian wey dey dedicated to sport, Africa, women and children.

She dey use her platform and influence to create positive and sustainable impact. To add from experiences from her personal journey, she serve on different sporting organizations around di world.

“If I dey passionate about sometin, I go do am, and I do am wit di competitive nature wey dem sabi me for.

“Even though I come from a landlocked kontri forAfrica, I dedicate over 20 years to become di top female swimmer for di history of di Olympic Games.”

Coventry attend five Olympic Games, she win 7 individual Olympic medals (2 Gold, 4 Silver, 1 Bronze).

She break plenti world records and get one of di best World Championship careers of all time.

She say she dey on a mission to kontinu to create constructive sustainable changes thru sport.

Kristy Coventry na member of di International Olympic Committee, Vice-President of di Zimbabwe Olympic Committee, Vice-President of di International Surfing Federation, and member of World Aquatics athlete committee and member of di World Anti-Doping Agency.

She also establish di Kirsty Coventry Academy and learn-to-swim programs, wey focus on youth development, health and education for Zimbabwe, with di aim to spread am throughout Africa.

Any African or woman don enta dat position bifor?

For di past 130 years no African or woman don enta dat position for di International Olympic Committee.

Since dem create di International Olympic Committee for 1894, na nine presidents di biggest sports office for di world don get.

For dis 130 years women neva really get di chance to hold di highest position.

Infact, na for 1981 wey dem allow di first set of women join di IOC as members.

Di IOC website describe am as a ‘milestone’ wen, for di International Olympic Committee Session for Baden-Baden, Germany, wen dem bin bring in two women into di board as Members for di first time.

Di women na Pirjo Häggman of Finland wey be two-time 400 metres Olympic finalist.

She bin dey involved wit administration for her sport and she bin also join di newly established IOC Athletes’ Commission.

Di second woman na Flor Isava Fonseca, wey also be equestrian competitor for Venezuela.

She bin hope to qualify for di 1956 Olympic Games but due to fracture wey she bin get for her femur she no fit compete to qualify again.

Na she bin start di equestrian federation for her kontri and later serve as presidential commissioner on sport.

Afta dis two IOC Members, odas join too afta dem introduce women’s events for cycling for di Los Angeles Games of 1984.

First female vice-president of di IOC?

Di highest position wey women don reach for di International Olympic Committee Board na di vice-president.

Anita DeFrantz, wey be rowing bronze medallist for 1976, be di Vice-President of di Los Angeles Organising Committee and na she plan di LA Olympic Foundation, wey She become IOC Member for 1986 and, by di time wey IOC dey celebrate dia centenary year for 1994, she don already be member of di Executive Board for two years. Dem set am up to encourage participation for sport.

She later contest successfully to become di first female Vice-President of di IOC.

Wetin bin ginger di IOC na “a strict enforcement of di principle of equality” wey go match wit dia policy of opening di Olympic programme to women.

Who be di oda contestants

Kristy Coventry wit her big profile and achievements in sports go face six candidates.

Di candidates na;

Sebastian Coe: Na di president of World Athletics Federation and two-time gold medalist for running, im bin represent Britain and becom di 1500 metres Olympic champion.

Juan Antonio Samaranch Jr: Im come from Spain, im papa bin don serve as IOC president for 21 years. Im be one of four IOC vice presidents.

David Lappartient: Im kontri na France and na di president of International Cycling Federation wey dey control cycling for di world.

Morinari Watanabe: Im be di president of di World Gymnastics Federation, im from Japan

Johan Eliasch: Di man wey from Sweden na di president of di Ski and Snowboard Federation

Prince Feisal al Hussein: Im from Jordan and im already be member of di IOC board.

All candidates don submit dia letters to contest ahead of di March 18-21 election for Greece.

Source