Anele Ngcongca dead in car accident: Life of South African Bafana-Bafana player wey die at age 33

Anele Ngcongca for Mamelodi Sundowns

Getty Images

Former South Africa midfielder Anele Ngongca die for car crash on Monday.

Di 33-year-old, wey play for Bafana Bafana during di 2010 World Cup, die at di scene of di accident as im bin dey drive between Johannesburg and Durban for South Africa.

Ngcongca bin dey travel to Durban to meet up wit im new AmaZulu team-mates, who im dey join on loan from Mamelodi Sundowns.

Im don help Sundowns win a third straight Premier Soccer League title last season.

Di two clubs release joint statement to confam di death and pay tribute to Ngcongca.

“AmaZulu and Mamelodi Sundowns FC extend dia deepest condolences to di Ngcongca family, former clubs, teammates, supporters and the broader football fraternity plus everybodi wey im don touch by di life of im exceptional football ambassador,” di announcement tok.

Im career include nine years wit Belgian club Genk wia im make more dan 200 appearance, e spend im final season on loan for France wit Troyes.

He also play for di World Cup and im dey part of di Bafana Bafana team for di 2013 and 2015 Africa Cup of Nations finals.