Leeds United vs Arsenal: Martinelli lead di way as Gunners thrash Leeds 4-1

Arsenal celebrate

Getty Images

Arsenal record comfortable 4-1 win over Leeds United as dem capitalise on di host poor display to put more grip on dia top-four position.

Gabriel Martinelli score twice before goals from Bukayo Saka and substitute Emile Smith Rowe ensure Arsenal cruise to victor despite say Leeds pull one back from Raphinha.

Leeds bin start di game without some of dia key players wey dey out due to injury.

Di Gunners capitalise on dia absence and di fact say some teams no play dis weekend to go four points clear for fourth position on di table.

Di spread of di Omicron variant of Covid across UK lead to postponement of six Premier League games.

Arsenal produce superb first half as di scoreline for increase wella but impressive performance by Leeds goalkeeper Illan Meslier, wey make fine saves to deny Saka, Alexandre Lacazette, Thomas Partey and Kieran Tierney.

How di match go

Second half

46mins: Arsenal begin di second half di way dem start di first wit pressure on Leeds Unite. Dem get two corners inside di opening minutes but Leeds clear di two.

50mins: Two incidents of potential red cards. First Xhaka go scot free afta im step on Raphinha. Di referee no give am card but later im hand Joe Gelhardt yellow card as im tackle Tomiyasu.

57mins: Stuart Dallas collect yellow card afta im pull back Arsenal defender Takehiro Tomiyasu.

63mins: Tomiyasu look like say im don get injury. Cedric Soares don come on to replace am.

67mins: Saka play one-two wit Martinelli but e come later shoot wide.

72mins: Leeds get dia first shot on target from Tyler Roberts. Aaron Ramsdale comfortably save am.

74mins: Penalty! Leeds United win penalty afta Ben White foul Gelhardt inside di box. Raphinha send Ramsdale di wrong way. Leeds 1-0 Arsenal.

78mins: Subtitution – Arsenal bring on Emile Smith Rowe for Saka while Leeds send on Sam Greenwood for Mateusz Klich.

81mins: Leeds make anoda substitution as Odegaard receive treatment. Liam McCarron come on for Summerville.

84mins: GOAL! Arsenal extend dia lead. Substitute Smith rowe volley in Odegaard through pass. Leeds United 1-4 Arsenal.

86mins: Granit Xhaka collect yellow card for time wasting. Later Leeds defend Koch also receive yellow for push on Martinelli.

90mins: Just like di first half referee add three minutes injury time.

Full time: Arsenal win comfortably in di end as dem hand Leeds dia third straight defeat. E finish Leeds United 1-4 Arsenal.

First half

Martinelli

Getty Images

1min: Leeds take di opening kick of di first half and immediately pressure Arsenal to concede corner kick. From di corner Raphinha head di ball over.

3mins Chance! Meslier produce not one but two good saves from Arsenal. First from Lacazette and den anoda one from Partey.

5mins: Wow! Di game start so fast wit those two early chances but tins don calm down small.

11mins: Gabriel Martinelli run down di left and pull di ball back into di box. Martin Odegaard step over am… but nobody dey behind am except Leeds defenders.

16mins: GOAL! Martinelli score to give Arsenal di lead. Leeds fail to clear di ball as Martinelli pounce on di loose ball to score.

24mins: Tierney test Leeds keeper wit shot from di left side. From di corner Leeds break quickly but Raphinha no fit convert as im shoot wide.

28mins: GOAL! Martinelli again. Leeds lose the ball again as Xhaka slide through pass to di Braillian wey calmly chip di goalkeeper. Leeds 0 – 2 Arsenal.

33mins: Chance afta chance afta chance na im Arsenal don get for dis match as dem dey dominate Leeds.

42mins: GOAL! Bukayo Saka increase Arsenal lead wit deflected shot wey Leeds goalkeeper no even bother.

45mins: After three minutes of added time, referee end di first half. Arsenal lead 3-0.