Gorillas wey dey treat demsefs fit get ansa for new drugs

Western lowland gorilla feeding on a plant

Getty Images
Less dan 150,000 western lowland gorillas dey alive for di wild for Central and West Africa

Researchers for Gabon don study di plants wey wild gorrilas dey chop and wey local human healers dey use, and dem don find four wey get medicinal effects.

Lab studies don find say di plants dey high in antioxidants and antimicrobials.

One get promise say e fit fight superbugs.

Great apes dey known to treat demsefs by selecting di plants wey get medicine.

One orangutan wey wound recently make headlines afta e use plant paste to take treat di injury.

Western lowland gorilla feeding on stems

Getty Images
Western lowland gorillas dey live inside forest, dey chop stems, bamboo shoots and fruits

For new study, botanists record which plants di western lowland gorillas for di Moukalaba-Doudou National Park for Gabon dey chop.

Dem find four trees wey dem find to dey beneficial based on wetin local healers tell dem. Di trees na di fromager tree (Ceiba pentandra), giant yellow mulberry (Myrianthus arboreus), African teak (Milicia excelsa) and fig trees (Ficus).

Di bark of dis tress wey dem dey use for traditional medicine to treat evritin from stomach wahala to infertility, bin get chemicals wit medicinal effects, like phenols to flavonoids.

Forests of Gabon

Getty Images
Gabon na one of di most biodiverse places for di world, wit plenti unexplored and potentially medicinal plants

All four plants bin show say dem get antibacterial effects against at least one multidrug-resistant strain of E. coli.

Dem tok say di fromager tree gan-gan bin show “remarkable activity” against all di strains dem test am wit.

Dr Joanna Setchell wey be anthropologist for di University of Durham for UK say, “e mean say gorrilas evolve to chop plants wey benefit dem and show say we no too sabi wetin dey inside di Central African rainforests.”

Dr Setchell bin work for di study wit di Gabonese scientists.

The fromager tree (Ceiba pentandra)

Getty Images
Di fromager tree (Ceiba pentandra) dey used by local medicine men for Gabon to treat sickness for human beings

Gabon get plenti forests wey pipo neva explore. Di forests get forest elephants, chimpanzees and gorillas plus many plants wey science neva sabi.

Poaching plus disease don make many of di western lowland gorillas to disappear for di wild.

Dem dey classed as critically endangered for di International Union for Conservation of Nature’s Red List.

Dem publish dis research for di journal wey dem dey call PLOS ONE

Source