UN announcement of $6 million donation, oda donations wey Borno don get since flood incident

Di Nigerian goment, several national and multi-national organizations plus individuals don dey send support in terms of relief materials, funds and aids give di Borno state goment afta di recent devastating flood wey lead to di death of ova 30 pipo, according to aid agencies.

Di recent Maiduguri flood for northeast Nigeria bin draw global attention as e affect millions of pipo and render hundreds of thousand homeless.

Dis na Borno state most devastating flood disaster in 30 years, according to di United Nations and local media.

Na one dam, Alau dam wey collapse afta one heavy rainfall cause di flood.

Aid agencies say at least 37 pipo die – but di authorities say e too dey early to confam dis estimate.

“We no fit confam di figure yet. For di number of houses wey dey affected, we gatz wait until di water level reduce,” Sirajo Garba, from di National Emergency Management Agency (Nema) for Maiduguri, bin tell BBC.

Di state govnor, Babagana Zulum, bin tok say more dan one million pipo fit dey affected by di flood.

E describe di extent of di damage as “beyond human imagination”.

Several organizations like di United Nations, National Emergency Management Agency (NEMA), di World Health Organization (WHO), Red Cross Society World Food Programme (WPF), Nigeria National Petroleum Company Limited (NNPCL), Federal Ministry of Humanitarian Affairs among odas don begin respond to di flooding crisis wit di provision of emergency food, medical supplies and cash assistance to pipo for hard-hit areas.

Di World Food Program say dis crucial assistance go enable affected families to fit meet dia basic food and nutrition needs while dem try to rebuild dia lives.

Borno State govnor Babagana Zulum during di flag off ceremony for di distribution of di relief materials for Bakasi camp tok say victims of di devastating Maiduguri flood dey take refuge inside about 36 camps.

E say di relief materials include one bag of 25kg of rice, one carton of pasta and N10,000 cash.

Some agencies, organizations and individuals wey don show support to Borno goment

For di wake of di incident, Nigeria President Bola Tinubu bin announce di immediate establishment of a Disaster Relief Fund wit one initial seed capital from di federal goment to help reduce di impact of di catastrophe.

“I urge di private sector to match or even pass Federal Government commitment to dis fund, and I appeal for increased global collaboration from our international partners.” Tinubu tok as e visit Maiduguri to syphatise wit those wey dey affected by di flood.

Di federal goment bin send a total of 100 trucks wey consist of 50 trucks of maize, 30 trucks of sorghum and 20 trucks of millet as relief materials to di flood victims. Di Minister of Agriculture and Food Security, Abubakar Kyari confam.

Di United Arab Emirates (UAE) send one plane wey carry 50 tons of food supplies come Nigeria.

For one statement on dia X account, UAE say na part of dia ongoing humanitarian efforts to support affected pipo around di world.

Di World Health Organization (WHO) say di Maiduguri flood affect more dan 230,000 pipo. Di health body say dis don hamper access to health facilities, schools and markets.

“Di flood don clear fourteen health facilitates. Serious watery diarrhoea, malaria, water-borne and infectious diseases, plus malnutrition na some of di major health risks wey go happun for di wake of di severe floods.” WHO tok for statement.

As part of dia immediate response, WHO say dem don deploy four mobile health teams wey comprise of 20 medical personnel wit essential drugs and medical supplies go di affected areas for Maiduguri.

“Di teams go provide treatment for minor ailments, routine immunization, antenatal and postnatal services plus mental health care and dem go refer serious medical cases go larger hospitals.

“Anoda WHO team of 50 frontline volunteers don dey deployed to carry out community active case search for water-borne and vaccine preventable diseases for camps where displaced pesins dey,” WHO add.

Nigeria National Petroleum Company Ltd also donate relief materials give di recent flood victims for Borno state.

Leadership of NNPC Ltd wey di Vice President, Business Services, Danladi Inuwa lead to pay condolence visit to di govnor say dem provide essential supplies like food, toiletries, beddings and oda household items to di affected communities.

Di United Nations say dem dey meals, shelter, health services & more emergency assistance to di Maiduguri flood victims, and dem go continue to support those in need.

President of di Dangote Group, announce di donation of N2 billion to assist those wey dey affected by di flood for Maiduguri.

Dangote explain say while di Presidential Committee on Flood and Disaster, wey im dey head commit N1 billion, di Dangote Foundation go donate additional N1 billion.

Dangote during one on di spot inspection for di flooded area say “I neva see any disaster of dis scale”.

Chairman/Chief Executive Officer of di National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, Mohamed Buba Marwa (Rtd) wey pay condolence visit to di govnor say im don contact fertilizer company to delover high yield fertilizers equivalent of ten trailer loads wey worth N120 million to di state goment.

Meanwhile, during di flag off for di distribution of di relief materials on Monday, 16 September, gonvor Zulum bin acknowledge di receipt of food donation from di Federal Ministry of Agriculture, National Emergency Management Agency (NEMA), and Nigerian National Petroleum Company Limited (NNPCL) to support di victims of di recent flood disaster.

Source