Eight major interesting things wey happun for Paris during di Olympic Games

Lyles, Khelif, Ana, Vinesh, Anthony

Getty Images
Pipo go remember dis Paris Olympics for many tins in and out of di games

Afta more dan two weeks of action-packed sport, Paris dey prepare for di 2024 Olympics closing ceremony.

E go take place on Sunday, 11 August and go hold for di Stade de France, wey don host athletics and rugby sevens during di Games.

E dey scheduled to start at 20:00 BST and finish at 22:30.

Di women’s basketball gold-medal match for Bercy Arena go be di final event for di competition for Paris 2024, and e dey scheduled to begin at 14:30 BST on Sunday.

Di 2024 Olympic Games for Paris don serve di good, di bad and di ugly.

Many kontris win gold, silver and bronze medals; and odas even though dem no win any medals, show di world wetin dia athletes fit do.

For some kontris like Saint Lucia, wey pipo no too sabi, dis na historic Olympics as dia female athlete Julien Alfred win one gold and one silver medal for di sprint competitions.

Dis tins bin trend during di games wia dey attract plenti interest from even pipo wey no follow di games proper.

Dis na some of di highs and lows of di Olympics wey form centre of discussion for many gatherings.

Nigeria Women Basketball make history as dem make am to di quarter-final

D'Tigress at di Olympics

Getty Images

Nigeria Women Basketball Olympic team reach di quarter final of di Olympics. Dis na one historic moment for di whole continent as no oda Africa kontri don qualify for quarter final.

Nigeria Women Basketball Olympic team wey pipo sabi as ‘D’Tigress; start di Paris Olympic games wit dia shocking win against Australia, wey dem beat 75-62.

D’Tigress also compete wit Canada wey dem win 79-70, dis na di game wey qualify dem for di quarter final until dem lose to USA during dia semi-final game.

Vinesh

Getty Images
Indian Wrestler Vinesh no fit fight for di final sake of im dey overweight on di morning of im fight

Indian wrestler Vinesh Phogat chop disqualification on di morning of her gold medal fight

For any athlete, di night bifor your medal-fight na big one.

But for Vinesh Phogat, on di morning of her 50kg category final fight, dem disqualify her sake of say she dey overweight.

Di Indian Olympic Association tok for statement say “na wit regret di Indian contingent dey share news of di disqualification of Vinesh Phogat from di women wrestling 50kg class.”

“Despite di best efforts by di team through di night, she weigh few grams ova 50kg dis morning.”

Vinesh

Getty Images
Vinesh announce say im retire from di sport afta im chop disqualification for di olympic final

Vinesh Phogat later announce her retirement wit emotional message on 7 August, afta she no fit compete for di fight of her life.

“My courage don break. I no gat strength now, goodbye wrestling (2001-2024). I go always dey indebted to you all for forgiveness,” she write for her social media page.

Vinesh na multiple gold medalist for di Commonwealth games for 2014, 2018 and 2022, wia she become di first Indian woman wrestler to win gold medal for di Commonwealth and Asian games.

She also win two bronze medals for di World Wrestling Championships.

American sprinter Noah Lyles win 100m gold even though im no be di first to cross di line

Noah

Getty Images
Noah Lyles na di world fastest man wit im new 100m win but im gat bronze for di 200m final

Noah Lyles na di fastest man for di world now afta e grab di gold medal for di ogbonge 100m final.

But di American bin snatch di win from Jamaican athlete Kishane Thomson wey carry leg cross di line first.

Lyles and Thomson both finish di race wit 9.79 seconds, but afta di photo-finish, na Noah dem declare as winner by just 0.005 seconds.

Na Noah carry im ‘torso’ wey make am win dis race; according to Olympic rules.

100m final

Getty Images
Noah Lyles carry im torso to beat Jamaican athlete Thomson for di 100m final

Di athlete wey im chest bin reach di closest edge of di finish line, na di winner – meaning say if your foot bin cross di line first, e neva dey count, not even pesin wey na im head.

Dat na di reason why athletes whenever dey reach di finish line, go push dia body forward to cross di line.

Lyles tok afta di race say “I just continue to dey run like I go win am. Sometin tell me say make I lean. Na dat type of race.”

Around di world, pipo bin tok about dis race – while some tink say na Thomson win am, odas agree wit di Olympics team say na Noah win.

Whichever way you tink am, di American don get di record for di fastest man for di world, until di next competition.

100m final

Getty Images
Dis 100m final race na one of di most controversial for di olympics, wey im require photo finish to determine who win am

Algerian boxer Imane Khelif beat Italian opponent Angela Carini in 46 seconds!

Dis boxing bout na one of di shortest for di history of di game, wey happun for dis Olympics.

Dis na di game wey don spark plenti tok-tok around di world about eligibility criteria for di women boxing game.

Angela tok afta di bout say im give up “to save my life.”

Di Italian neva recover from one punch wey di Algerian boxer take hit am, Carini bin dey cry afta di fight like baby.

Na so pipo begin dey question if Imane Khelif be woman, sake of wetin Carini tok, she say her punch dey heavy and she never receive dat kind blow bifor.

Imane Khelif

Getty Images
Imane Khelif beat Angela Carini in 46 seconds for dia first bout at di Olympics

Many tori for social media bin dey suggest say Imane na transgender.

Butshe comot say she Imane Khelif na woman, and she dey identify as woman since.

Di tok-tok pesin for di International Olympic Committee (IOC) Mark Adams tok say, “testosterone test no be perfect test bicos plenti women fit get testosterone, but dem be women and dem don dey compete as women.”

Oga Adams add say “dis no be transgender mata, everibodi sabi dis one, but some pipo don misreport di mata. Dis woman bin dey participate for women competition for many years.”

Imane Khelif and Angela Carini

Getty Images
Di Algerian Olympic Committee and di International Olympic committee don support Khelif wey dey condemn di attacks on di female athlete

Di Algeria Olympics Federation issue statement to condemn di attack on dia boxer wey dem tok say stand by Imane Khelif.

Di athlete herself tok say dey focused on di goal to win medal, afta dem disqualify herself and anoda Taiwanese female boxer for di 2023 world championships, say dem fail “eligibility tests”, according to di International Boxing Association.

Imane Khelif now make history for Algeria as she win gold medal for di Olympics.

Afta she win, Khelif tok say “from dreams to reality, di journey na gold.”

She add say “I dey proud to stand at di top for my kontri and di pipo wey believe – di fight neva dey stop, e only dey get stronger.”

Imane Khelif

Getty Images
Di female boxer na icon for her home kontri wia she be UNICEF ambassador

French pole vault athlete manhood knock am out of di tournament

Anthony Ammirati dream to win medal for France for di pole vault no go according to plan.

Di 21-year-old for di men’s qualifying event on 3 August miss di target height afta im manhood crash di crossbar wey make am fall down.

Pictures and videos of di incident bin trend for social media.

Anthony

Getty Images
Athony Ammirati no fit reach di final of di pole vault afta im ‘manhood’ clear di bar wey e drop

Di athlete wey clear 5m60 don dey ranked 15th for di Paris Olympics.

“Na big disappointment” di first-time Olympian tok inside one statement wey di French Athletics Federation post.

“Di conditions be good, I gat only one goal say make I play wit di audience. I almost reach dia.”

Ammirati also don share di tribute wia French sports academy Envol don post about am but im no comment about di moment wey knock am out of di competition wey don go viral.

Swedish athlete Armand Duplantis wey win di gold medal for dis pole vault, but Anthony Ammirati wey bin dey di lips of many pipo sake of how im manhood block im chance to win medal for di games.

ANTHONY

Getty Images
Anthony chop 15th for di games

French Olympian propose to boyfriend afta setting record

Alice Finot

Getty Images
Alice finish 4th for di women’s 3000m steeplechase final.

French athlete Alice Finot bin celebrate im record-breaking feat for di Paris games wit proposal.

Alice finish 4th for di women’s 3000m steeplechase final.

Despite di fact say she miss di podium (medal zone) by 3 seconds, Alice don break di European record.

To celebrate di achievement, di 33-year-old first-time Olympian go on her knee for di stage de France and she propose to her boyfriend.

Alice Finot

Getty Images
Alice afta she finish di 3000m steeplechase final propose to her boyfriend

Alice wey bin dey hold one pin, put am on top im partner shirt, and di two of dem hug and kiss each oda.

Di official NBC Olympics & Paralympics X account bin share di video of di emotional surprise wey get ova 4.5 million views.

Many pipo for social media react to di video, and some of dem write say “love go sweet.”

Finot bin cross di finish line for di 3000m steeplechase at 8:58:67 wit gold medallist Winfred Yavi of Bahrain wey clock 8:52:76; Uganda’s silver medallist Peruth Chemutai finish wit 8:53:34 while Faith Cherotich also from Uganda also win bronze wit time of 8:55:15.

Alice Finot

Getty Images
Alice and im boyfriend bin share emotional moment afta she finish di race

Police arrest Australian hockey player afta im allegedly go buy cocaine

Paris prosecutor office bin announce say dem arrest one pesin on Tuesday night 6 August on top accuse say e buy cocaine for di ninth arrondissement.

Di pesin na Australian hockey player Tom Craig.

Authorities say dem release Craig wit warning so dem no convict or fine am.

Di athlete afta dem release am say “I dey apologise for wetin happun, na terrible mistake I make. I take full responsibility for my action.”

“Wetin I do na my own action, e no reflect di values wey my family, teammates, di sport, friends and di Australia Olympic team get. I don embarrass una, I dey sorry.”

craig

Getty Images
Craig don apologize for im action wia im ask for forgiveness

Di 28-year-old win silver for di Tokyo 2020 games, wia e make more dan 100 appearances for Australia.

Di Australia chef de mission Anna Meares tok say im happy say dem release Craig but im no fit “accept wetin e do.”

She add say “E be good pesin wey make one bad decision but consequences dey for such bad decisions.”

craig

Getty Images
Both di men and women’s Australia hockey teams don comot for di quarterfinal stage for di Paris Olympics.

Meares tok say Craig don already comot di Olympic village and e go lose di remaining privileges for di games.

Bifor im release, di prosecutor office tok say “police officers witness di cocaine transaction for di foot of di building wia dem arrest di seller and di buyer.”

Dem add say “given di quantity of drugs wey dem seize from di seller, we don hand ova di investigation to di anti-narcotics police.”

Both di men and women’s Australia hockey teams don comot for di quarterfinal stage for di Paris Olympics.

Brazil send dia female swimmer home afta she go out wit her boyfriend

Di Brazilian Olympic committee bin sack swimmer Ana Carolina Vieira from dia camp afta offence of “misconduct”.

Dis na afta Vieira and her partner wey also be swimmer wit di male team Gabriel Santos comot to visit some places for Paris.

Officials don blast di two athletes for dia actions but di Olympic Committee say dem send Vieira home sake of say she act for “disrespectful and aggressive manner” towards di disciplinary committee.

Di Brazil men and women 4x100m freestyle relay teams no qualify for di final.

Ana

Getty Images
“Discipline, determination and education be my pillars as a high performance athlete” – Ana Vieira tok

Di head of Brazil Swimming team Gustavo Otstuka tok say wetin Vieira do dey “completely inappropriate.”

But Vieira afta she comot di Olympics village bin react to di decision.

She tok for her Instagram page say wetin happun na “communication failure wey destroy my Olympics dream.”

“Discipline, determination and education be my pillars as a high performance athlete,” Ana Vieira write.

Ana

Getty Images
Ana tok say di way dey sack am from camp don affect am psycholigically

Di 22-year-old athlete through her lawyers bin issue statement wia she explain say, she and her boyfriend bin visit di Eiffel Tower, and dem stay out for just one hour 15 minutes.

“Vieira and Santos bin visit di Eiffel Tower on 25 July during dia free time to celebrate dia careers and dem return wit di official vehicle wey dey assigned to di competitors,” di statement by Vieira lawyers tok.

“On 26 July di technical committee say di athletes say dem don drop one pesin but Ana Vieira wey bin dey committed to di course bin object to di decision, make pipo no describe her rejection as aggressive or disrespect.”

Di statement add say “On 28 July, dem dismiss Ana Vieira without opportunity to defend herself.

Dis don affect her psychologically and e cause her harm. We go ensure say necessary investigation go happun for dis mata,” di statement by Octavio Rolim, conclude.

Source