Tori of woman wey suffer abuse as she bin dey travel from Akure (south west Nigeria) to Abuja (Nigeria political capitla) make Nigerians hala for sexual molesters on Tuesday.
Dis dey happun just days afta kontri pipo begin use di hash tag ‘#SayNoToRape’ to hala ontop tori of girl wey dem sexually molest inside one church for Benin (southern Nigeria)
For dis video tweet wey BBC Pidgin no fit verify wen and wia e happun, one Nigerian narrate how pesin wey im call im sister suffer harassment from male passenger as she dey travel.
Di video, e show as di man wey bin dey di same bus wit her chook im hand for under her skirt all through di journey from Akure go Abuja, according to di tori.
Tori be say, she bin dey shout on top wetin di man bin dey do her, but pipo for di bus say she dey overreact, na why she do di videpo.
According to di tweet, she bin try report di mata to one soldier wey she see for road but di soldier tell am say make she keep quiet or dem go arrest am because di man follow di soldier speak Hausa.
How pipo dey react ontop di mata
Pipo for social media don dey para up and down as dem dey find di man wey abuse dis woman for inside bus.
See someone role model, father, uncle, grandpa, brother, molesting a young lady in a public transport from abuja to akure.
Wtf.. See my kind blaming the young lady for been calm what did you expect her do .. This has to stop #SayNoToRapist pic.twitter.com/Sgoj8r9Fpv— FUOYE_Tweet (@fuoyetweet) June 2, 2020
Somebody’s daddy doing this to a lady??? This is rape!!! He plans on doing this from. Abuja to Akure can you imagine,Dey shld arrest him pic.twitter.com/lM9MwOsGyd
— Chukwukere Nwamaka (@ma_queen_c) June 2, 2020
This is a pure sexual harassment case and we have good Laws on this in Nigeria that gives the government/police the power prosecute him in court.
Abuja to Akure
— Adeoye Damilare (@DamilareAdeoye) June 2, 2020
That lady molested from Abuja to Akure WASN’T at fault in any way, Yall ignorant SIMPS saying “why didn’t she..” why didn’t she do what? She fckin complained! Even reported to a Soldier ffs! and he told her to keep quiet, so how on earth are dumbasses still tryna Justify this??
— 🍷 Daddy oyoyo (@Blaaq_ie) June 2, 2020
This man in the abuja to akure video is a potential rapist…. the boldness ,the effrontery, Without rumination of any consequences whatsoever … Lets just make his face popular pic.twitter.com/tHO0JmSjyS
— Oga Web Designer🇳🇬 (@samCodeNg) June 2, 2020
Di picture don dey circulate for social media and “Akure to Abuja” don dey trend.