Arsenal beat PSG to secure first UCL 24/25 victory

Foto of Bukayo Saka

Getty Images
Bukayo Saka celebrat im goal for Arsenal

Arsenal get dia first win for di new Champions League as dem beat Paris St-Germaine for di Emirates stadium.

Di Gunners score two goals for first half from Kai Havertz header and free kick from Bukayo Saka.

PSG bin get chances but dem no convert dia chances.

Juno Mendes and Joao Neves hit di bar of di goal post as dem miss clear goal chances.

PSG try evritin but e no work for dem today.

Arsenal victory victory come from dia fine opening 45 minutes wey give dem a deserved two-goal advantage and help dem manage di second.

Dis is a PSG team in major transition afta decision to move on from di era of wen dem buy superstars, but di way Arsenal control di first 45 minutes na anoda sign of di growth of di Gunners under Arteta.

As dem take control of di game wit Havertz goal, wey show bravery and commitment to reach Trossard delivery ahead of Donnarumma wey dey rush come and Saka strike from a free-kick, Arsenal play in a way wey go make dia coach happy.

Match highlights

Fotos of Arsenal Manager, Mikel Arteta and PSG Manager, Luis Enrique

Getty Images
Mikel Arteta/Luis Enrique

Second Half

Full time Arsenal 2-0 PSG

90+5 Match don end.

90+2 Substitution Saka of Arsenal don comot Myles Lewis -Skelly don enta.

90+1 Gabriel Jesus of Arsenal run towards goal but defender block di challenge.

90’ Four minutes added time.

88’ VAR review of di incident wey bin happun inside di box wey im bin no see but afta review NO PENALTY!

87’ Randal Kolo Muani of PSG run enta di box im try to challenge im opponent but referee signal NO PENALTY!

85’ PSG get corner kick, Kang -In Lee play am, e land for Marquinhos head but im miss di target as di ball fly over di bar!

83’ Referee stop di match sake of foul wey Kai Havertz commit.

78’ E be like say Riccardo Calafiori of Arsenal hold ball inside di box, but referee no see am well.

77’ Fabian Ruiz of PSG chop yellow card too.

77’ Yellow card for Riccardo Calafiori of Arsenal.

75’ Gabriel Martinelle of Arsenal pass one ball wey fit divide any defence into two, im put di ball towards di middle of goal but PSG goalkeeper Donnarumma save di ball.

74’ Substitution for Arsenal, Leandro Trossard don play finish, Gabriel Jesus don enta.

73’ Kai Havertz of Arsenal put too much power as im Dey try to get space from im opponent but referee blow whistle for foul.

70’ Arsenal dey play short short passes.

66’ Over di bar! Joao Neves of PSG see space to meet di corner kick e fire shot but e go over di bar!

66’ Corner kick for PSG, Kang-In Lee get chance to put di ball for di left corner of di box.

64‘ Substitution for PSG Vitinha don comot Fabian Ruiz replace am.

64’ Desire Doue comot for Kolo Muani

60’ Achraf Hakimi fall inside di box afta one tackle from defender, refwere say play on!

58’ Kai Havertz of Arsenal jam cross inside di box but PSG player block im header.

56’ Gianluigi Donnarumma of PSG jump as im try to collect ball from corner but di Declan Rice play di ball over.

55’ Gabriel Martinelli of Arsenal play one beta cross but PSG defence clear am.

51’ One pass inside di box meet Gabriel Martinelli of Arsenal, im play si ball towards di middle of goal but Gianluigi Donnarumma save di ball last minute.

51‘ Declan Rice of Arsenal play one cross wey no disturb di PSG defence.

48’ Kai Havertz of Arsenal do one rough challenge and referee blow whistle for foul.

48’ Kang-In Lee of PSG pass di ball into di box but Arsenal defenders block am.

48’ PSG dey try build up as dem dey try to break Arsenal defence.

46’ Substitution for Arsenal Jakub Kiwior don enta for Jurrien Timber.

46’ Second half don start

First Half

Arsenal vs PSG

Getty Images

Half time Arsenal 2-0 PSG

45+2 Referee blow whistle first half don end.

45’ Referee add 1 minute.

44’ Saka of Arsenal again send long pass to Leandro Trossard, but im put too much power.

44’ Bukayo Saka waste anoda chance for Arsenal as e play free kick wit short pass.

42’ Kang-In Lee of PSG fouls im opponent , Referee blow whistle for foul.

38’ Linesman raise im flag for as Bukayo Saka of Arsenal dey offside.

35’ Arsenal 2-0 PSG

35’ Bukayo Saka of Arsenal score for Arsenal wit beta free kick and na from far place. Even though im target di middle of di post goalkeeper no fit save am.

35’ GOAL!!

33’ Dem clear di ball afta Warren Zaire-Emery make attempt to dribble past im opponent.

31’ Corner kick for PSG, Kang-In Lee play am but one of di defenses for Arsenal block so ball.

31’ Achraf Hakimi of PSG collect one beta pass e take am arrange di ball, before im fire am to di bottom corner of di post but David Raya save am.

28’ Miss! Nuno Mendes of PSG fire shot from outside di box but e hit di right post.

25’ Bradley Barcola of PSG make a solo run but I’m no fit create any chance as Arsenal player block am.

23’ PSG players dey exchange short short passes to try draw Arsenal to come out.

20’ Arsenal 1-0 PSG

20’ Kai Havertz of Arsenal don score afta im jump to connect wit one beta cross from Leandro Trossard. Im plant so long range cross as im head am to do left corner of di goal post. Donnarumma no fit save am.

20’ GOAL!!

19’ Kai Havertz of Arsenal pass di ball into di box but dem block am.

16’ Referee blow whistle for Bukayo Saka of Arsenal afta one bad tackle.

13’ Bukayo Saka of Arsenal cross di ball into di box but Gianluigi Donnarumma come out from im line to clear di ball.

10’ Di ball bounce back go meet Nino Mendes of PSG for Aimee of di box. Im strike di ball sharp – sharp towards goal but e go over di bar!

10’ PSG get corner kick and and Kang-In Lee go play am.

10’ Achraf Hakimi of PSG bin get chance to break free but Arsenal player clear di ball.

9’ Bukayo Saka of Arsenal enta beta position for di box afta a im collect one pass, but I’m okay di shot over di left post.

6’ Referee blow whistle afta Joao Neves of PSG use force tackle im opponent wen e dey try attack.

5’ Gianluigi Donnarumma of PSG don get up afta im bin go down and call for medical attention.

3’ Gabriel Martinelli of Arsenal collect beta warning from Referee sake of one bad tackle.

2’ Now now Kai Havertz of Arsenal don go offside!

1’ Referee Slavic Vincic don blow whistle and match don start.

Line-Ups

Arsenal starting 11: Raya, Timber, Saliba, Gabriel, Calafiori, Partey, Rice, Havertz, Saka, Martinelli, Trossard.

PSG starting 11: Donnarumma, Hakimi, Marquinhos, Pacho, Nuno Mendes, Vitinha, Zäire-Emery, João Neves, Douē, Lee Kang-In, Barcola

Source