Ratings of possible candidates for Klopp replacement as Alonso no want Liverpool job

Jurgen Klopp

BBC

Liverpool still need to find replacement for Jurgen Klopp afta bookmakers and fans favourite Xabi Alonso announce say im go stay for Bayer Leverkusen.

Di former Spain midfielder, wey dey on course to lead Leverkusen to di Bundesliga title, na reported target for Liverpool and Bayern Munich – two of di clubs wey im bin play for.

Liverpool need a new manager for di first time since October 2015, afta Klopp tok say im go step down at di end of di season.

Klopp don win di Champions League, Premier League, FA Cup, two League Cups, Club World Cup and Uefa Super Cup during im Anfield tenure – and Liverpool still dey chase win di Europa League and di Premier League dis campaign.

Carteret Analytics, wey dey provide detailed manager assessments to Premier League, EFL, Bundesliga and MLS clubs, don assess a series of possible candidates, as well as Klopp, to see who fit do di best job.

Wen dem bin first do di analysis, Alonso – wey bin still dey di race – rank fifth out of di six potential candidates.

Di company say: “Aside di ogbonge success wey Klopp achieve ova di past six seasons in terms of results, im individual metrics demonstrate exceptionally high level of ‘football intelligence’.

“For example, im strategic intelligence rating dey veri high. Im tactical command rating dey even beta.”

If you dey wonder wetin strategic intelligence and tactical command be, read on. To work out di pesin wey go replace Klopp, na all about di metrics.

We go list di candidates in order of dia suitability according to Carteret analysis, based on a number of key metrics to give objective sense of di strengths and weaknesses for each head coach.

(Di findings dey based on actual results achieved ova di past six seasons, wey dey weighed towards di most recent seasons, and relative to di strength of di league wia dem achieve dose results.)

Managers

BBC

How dem rate di managers? Di metrics dem use

Objective achievement rating: Na measure of overall ability based on di koko wey say di primary objective na to win football matches – rather dan, for example, long-term player development or balancing of di club finances.

Overall rating (weighted metrics): overall rating score, dey based on di actual achievements of di head coach ova di past six seasons, but e dey weighed according to dia individual performance – so di kwesion na weda dem dey overachieve or underachieve for dia job?

Strategic intelligence rating: Dey measure di manager ability to prepare and set im team, and analyse di opposition, to maximise di chances of winning di next match.

Tactical command rating: Dey measure di manager ability to transform a match (during di match), and, in particular, to develop a winning position for di team from various match scenarios.

Attacking coefficient/success-adjusted attacking coefficient: Dey measure di manager ability to play attacking style of football – and di relative impact of di manager attacking coefficient on di success of di team. If dis style go bring wins?

Team shot conversion rating/opposition shot conversion rating: Na key metric wey dey highlight one team ability to increase di probability of winning matches. Di chances wey dem create dem dey take am?

Shot creation ratio: How many chances a manager team dey create.

Possession: How much of di ball a team get.

Sporting Lisbon manager Ruben Amorim

Getty Images
Sporting Lisbon manager Ruben Amorim bin win di Primeira Liga title for 2021 as well as two Taca da Liga trophies wit di club

Ruben Amorim (Sporting Lisbon) – even better pass di real tin?

Portuguese manager Amorim, 39, don emerge as Carteret surprise ideal candidate to take ova for Anfield.

Im profile rise afta im guide Sporting to dia first top-flight title in 19 years for 2021 and Carteret say all di analytics dey point to am to “become a veri compelling option as di next Liverpool manager”.

Dose findings make allowances for di fact say Amorim experience dey for a less competitive league, but e say im strategic intelligence rating, im tactical command rating, success-adjusted attacking coefficient and shot creation ratio all even high pass Klopp wit equivalent shot conversion rating and overall levels of possession.

Julian Nagelsmann (Germany interim manager) – hype, headaches and one patient ‘genius’

Di former Bayern Munich boss, 36, bin take ova as Germany manager for September but im contract only run until July 2024 and im go dey available afta dis summer European Championship.

Im bin previously share di same agent as Klopp – Marc Kosicke – and di current Liverpool manager bin describe am as a “young horse” and a “big, big coaching talent”, Carteret give am di highest strategic intelligence rating of anyone.

Dia findings suggest say di German get a defensive approach but one wey im dey make to work for im teams, wit a veri methodical, patient and probing style of play.

Carteret point out, though, say im interpersonal skills go need to dey researched more fully and say im style of play fit become problem if e no win matches.

Thomas Tuchel (Bayern Munich boss) – dey defensive

Wit di exception of Klopp, Carteret bin find out say Bayern boss Tuchel – wey dey leave im post dis summer – na “di best of dis group of head coaches to demonstrate di ability to win matches for di requisite level” in recent years.

Tuchel rate well for setting up im teams to maximise di probability of winning di next match, but Carteret find out say im fall short of Klopp for im ability to transform matches.

Di former Chelsea boss, wey bin lead Bayern to di title last season, dem also find out say im get “a veri similar defensive style of play as Nagelsmann, and dem add say dat fit prove to be challenge for Liverpool supporters and for maximising di attacking coefficients of di current Liverpool players”.

Ange Postecoglou (Tottenham) – attack, attack, attack… or a be?

Carteret find some strong similarities between Postecoglou, 58, and Klopp – wit strategic intelligence, tactical command, and shot creation ratio broadly equivalent (although all lower dan Klopp), na overall possession.

Dem find out say, Postecoglou attacking coefficient na (23.18) – 16% lower dan Klopp.

Carteret say dis indicate a less progressive style of play – and add say di defensive elements of dat style also dey less successful.

“Wen you consider some of di fundamental metrics wey dey indicate, empirically, transferable success traits, e rank am high as di next Liverpool manager. But, beta candidates dey,” Carteret tok.

Roberto de Zerbi (Brighton) – passionate style?

Wit di exception of im brief stay for Shakhtar Donetsk – wen im bin win two-thirds of im matches and lead dem to Ukrainian Super Cup – De Zerbi teams dey tanda for mid-table, Carteret tok.

E no get a lot for assessment of im results wey go suggest say im fit win di Premier League wit Liverpool.

Carteret also find out say none of im metrics match Klopp own. Im dey significantly lower across di board – strategic intelligence, tactical command, attacking coefficient and shot conversion.

Dem say: “De Zerbi certainly don create headlines for UK (like Brighton as a club in generally), but a fully objective analysis of im performance levels (rather dan a subjective view of im approach and personality) show say im fall short significantly (for evri key metric) for wetin dey required for the next Liverpool manager.”

Source