NNPC career site ‘crash’ one hour afta dem announce recruitment exercise

Di Nigerian National Petroleum Company (NNPC) Limited say dem dey experience a downtime about one hour afta dem announce one recruitment exercise for qualified applicants for dia social media platform.

Di exercise dey expected to close for 20 August, 2024.

Di national oil giant company for one statement on dia X account explain say di reason why di site ‘crash’ na sake of di plenty applicants wey don visit di site to apply for vacancies.

“Due to unprecedented traffic to di NNPC Ltd. Career page from applicants wey dey apply for vacancies, di site currently dey experience slow load times.”

Wen BBC Pidgin click on di link dem share, true-true e no dey go.

Di statement add say dia technicians dey work diligently to rectify di problem as quickly as possible.

E no dey common to see or hear NNPC publicly advertise dia recruitment and dis announcement come as surprise to many Nigerians.

Plenty reactions don follow di announcement as di site no dey respond.

However, NNPC don assure applicants say make dem relax dia minds as dia team dey work very hard to collate all di applications.

Dem also say di recruitment process go dey “transparent and merti-based.”

Nigerians react to NNPC recruitment exercise announcement

Different reactions don follow di rare recruitment exercise wey di NNPC announce.

Some Nigerans for social media express dia distrust for di exercise as dem claim say na distraction to di planned 1 August nationwide protest.

While some see am as welcome development, odas lament dia inability to apply for di vacancies, some odas connect am to di gbege wey bin happun between di Federal Government and Aliko Dangote, di President of Dangote Group and CEO of di Dangote Refinery.

Di planned protest against economic hardship, don dey trend for social media continuously for some weeks now.

Pipo dey complain say dem no fit afford to buy some food and basic commodities sake of say di price don go high.

Nigeria dey battle one of di kontri worst inflation and economic crisis wey goment policies on petrol subsidy removal and unification of forex windows join cause.

Figures released by di National Bureau of Statistics on Tuesday show say di prices of staple foods for Nigeria like rice, beans, tomatoes, potato and yam rise by more dan 250% between May 2023 and June 2024.

Source