One Direction star Liam Payne die afta e fall from hotel balcony for Buenos Aires

Liam Payne

Getty Images

One Direction star Liam Payne don die after e fall from di third floor of a hotel balcony inside Buenos Aires, Argentina.

Police say dem call dem to di hotel after reports of one “aggressive man wey fit don dey under di effects of drugs and alcohol”.

Payne fall from di balcony after officers arrive, di statement add.

Fans don gada outside di hotel – Casa Sur hotel Palermo – to mourn di 31-year-old death – lighting candles, singing One Direction songs and holding moments of silence.

Payne, from Wolverhampton for UK, rise to global fame wen One Direction start for di X Factor show for 2010.

Dem become di biggest boy band for di world, before dem take break for 2016. Payne release im only solo album for 2019.

One Direction na one of di biggest bands of di 2010s.

Dem sell 70 million records, with songs wey everybody fit know – like What Makes You Beautiful, Story of My Life, and Best Song Ever – wey dominate di air waves.

Liam Payne with im One Direction band mates

Getty Images
Liam Payne with im One Direction band mates

Inside posts for social media platform Snapchat days before im death, Liam Payne talk about riding horses, playing polo and watching im former bandmate Niall Horan perform live for Buenos Aires.

Videos wey e share from di concert on 2 October show am dey dance with im girlfriend Kate Cassidy, waving to fans for di crowds, and singing along to One Direction old hits.

E bin post one selfie with Horan, and talk about how proud e dey of di Slow Hands singer.

Hours before im death, Payne post for Snapchat say: “Na a lovely day here for Argentina.”

Wetin we sabi so far about Liam Payne death

  • Warning: Some readers fit find dis post distressing
  • Local police say a 911 call alert dem to “an aggressive man wey fit dey under di effects of drugs and alcohol” for di Casa Sur hotel where Payne bin dey stay for Buenos Aires.
  • Argentine media dey report say di emergency call came from a hotel manager, wey report a guest “on drugs and destroying di room”, according to di AFP news agency.
  • Di manager according to reports tell di operator say di guest “get balcony, and we dey fear say e fit do something to put im life at risk”.
  • Dem find Payne dead outside one hotel for Buenos Aires after di 31-year-old fall from a third-floor room balcony, according to Argentine police
  • Soon after dia arrival, dem tell dem say dem hear one loud sound for inside di hotel courtyard, wia dem later discover Payne body
  • Di head of di city SAME emergency medical service tell local media say dem carry Payne go hospital but e bin don suffer “very serious” injuries as a result of di fall and “no possibility to revive am” dey
  • Dem don launch investigation. Di UK Foreign Office say dem dey in touch with authorities for Argentina
  • Some of di biggest names for music don pay dia respects – British singer Olly Murs say e dey “devastated”, while US musician Charlie Puth remember Payne kindness
  • Fans also express shock and sadness – with some wey gather outside of di Casa Sur hotel where dem find Payne body to sing together and hold vigil wey dem no plan

Life and times of Liam Payne

Liam Payne

Getty Images

Liam Payne first try for stardom wen e bin audition for X Factor for 2008 – but judge Simon Cowell tell am to “come back in two years”.

E come back, e impress di judges dis time more for 2010, after performing Michael Buble version of Cry Me A River.

Dem put am together with four other solo hopefuls for di boot camp stage. Na so One Direction dey born – dem no win di talent show, but dem fast -fast find big chart success and become di world biggest boy band.

With One Direction, e discover a talent for songwriting. E get writing credits for half of di band final two albums, for songs like History, Steal My Girl and Story Of My Life.

One Direction sell 70 million records and play to thousands of fans around di world.

Inside interview with BBC for 2019, di singer say e no get any regret.

“I no go change am,” e tok. “I know say na where I supposed dey in di world now.

“I bin dey very confused about fame when everything happen; and learning to be person outside of your job bin dey difficult. But now, I feel like I don get am. I be lucky boy.”

One Direction get four UK number one albums and four number ones singles as well as topping charts around di world, before dem break up five years later.

For 2017, Liam debut solo single Strip That Down wey reach number three on the Official UK Chart, and im collaboration with Rita Ora for di song For You – from di Fifty Shades Freed soundtrack – also reach di top 10.

E also collaborate with some of pop biggest writers, including Ed Sheeran, Charlie Puth and Ryan Tedder of OneRepublic.

“Writing for One Direction na a different process because you know wetin di kids want,” e bin tell BBC.

“I love those songs – no get me wrong – but I know why I bin dey write dem and I know wetin I dey write dem for.”

For im solo songs, e most times avoid writing love songs, instead focusing more on mature topics like depression, sex and heartbreak.

“E be like say I be absolute expert on heartbreak,” e tok. “I think, for me, e bin dey easier to write from a sad place, because di feelings bin dey a little bit more raw.”

Im and Girls Aloud star Cheryl start relationship for 2016 and dem get one son, Bear, di next year. Di couple break-up for 2018.

In recent weeks, tori bin dey go round for social media about im behaviour towards other former partners, with one wey report on Tuesday say take legal action to stop am from contacting her friends and family.

One Direction (l to r) Niall Horan, Louis Tomlinson, Harry Styles, Liam Payne and Zayn Malik arrive for one autograph signing session for di HMV store, Bradford for 2010

PA Media
One Direction (l to r) Niall Horan, Louis Tomlinson, Harry Styles, Liam Payne and Zayn Malik arrive for one autograph signing session for di HMV store, Bradford for 2010

Source