Ogbonge gospel singer Aduke Gold dey make her final journey home

Di death of ogbonge gospel singer Aduke Ajayi wey many sabi as Aduke Gold bin shake di music industry and her fans for Nigeria.

Monday 12 August, 2024 enta wit tears and sad mood for many gospel singers and fans of Aduke Gold wen di news of her death bin spread.

Dem go lay her to rest on Friday 23 August, 2024.

Aduke elder broda Pastor Ajayi Aderounmu tell BBC say na cervical cancer kill di gospel singer.

“Regarding Aduke death, cervical cancer kill am, becos e appear for her death certificate,” Pastor Aderounmu tok.

Di death don cause pain for many wey no expect say she go die so early sake of say dem no suspect say she dey battle any sickness.

One of di close friends to Aduke Gold na di superstar Tope Alabi wey many gospel musicians take as mentor.

Di death of Aduke bin shock her becos dem be friends from di beginning.

“Aduke, you know say I love you, but Jesus love you more. Rest in perfect peace, “dis na wetin Tope Alabi write for her Instagram page.

Anoda ogbonge gospel singer Esther Igbekele mourn di death of Aduke Gold as she remember how dem take start togeda.

“You bin start very young as Aduke Penkele to grow big to Aduke Gold. But today you no dey again. Heaven don gain one angel. Sleep on dearest sister,”Igbekele write.

According to many pipo, Aduke Gold na very happy and lively pesin wey don use her music help di life of pipo.

Dis gospel singer don sing for plenti churches for Nigeria and also collabo wit plenti fellow singers for di Christian space.

Tori of how Aduke bin die still dey surprise some pipo but di hospital wia she die tok say treatment bin dey go well bifor she die.

Dem rush Aduke go hospital and tok-tok pesin for UCH Funmilayo Adetuyibi bin tell BBC say na dia hospital Aduke Gold die.

She add say dem bin refer Aduke Gold to UCH from Olabisi Onabanjo Teaching Hospital for Ogun State on 3 August.

She bin wan do diagnosis to find more wetin dey wrong wit her, but na dia she die.

How Aduke Gold rise

Dem born Aduke Ajayi, wey many pipo sabi as Aduke Gold, for 1990 for Ilesha, Osun State.

Aduke Ajayi bin lose both her parents wen she dey four years old and she live for her elder broda house for some years.

Wen she first start her music career, pipo bin dey call her Aduke Penkele sake of how slim she dey and look for stage.

Di late Aduke Gold bin get opportunity of free education to go university wen one commissioner for Youth Affairs and Sports for Lagos State at dat time, Opeyemi Bamidele, bin give free education.

She graduate from Lagos State University wit degree for International Relations.

Late Aduke Gold also study about children, and gbab Diploma award for United Kingdom.

Aduke Gold also learn about pipo wit special needs, di care and breeding of fish, teaching and cake making, apart from di music wey make her popular.

On Monday night, August 12, 2024, Aduke Ajayi bin leave di world afta she battle sickness wey she no survive.

Pictures from di burial

Aduke Gold burial ceremony

BBC
Aduke Gold burial ceremony

BBC
Aduke Gold burial ceremony

BBC
Aduke Gold burial ceremony

BBC

Source