Fotos, latest from Davido and Chioma celebrity wedding

All don set for di wedding of di superstar musician Davido and im long time fiancée Chioma for Lagos state, Nigeria.

Di Unavailable artiste bin first announce dia engagement for 2019.

Davido bin first address Chioma as im wife for 2023 wen e yan say e no go dey tok too much about im private life for social media.

But Davido shock im fans for June 2024 wen im announce officially say im wedding go happun in di coming days, and di subsequent release of di ‘Chivido’ pre-wedding pictures set di internet on fire.

Di couple get three pikin between dem, although dem lose dia first born Ifeanyi for November 2022.

More updates go dey drop as e land.

Di wedding dey hold for Harbour Point for Victoria Island for Lagos.

As at now many ogbonge personalities don already land di event.

Di govnor of Osun State, Ademola Adeleke, former President of Nigeria, Olusegun Obasanjo among odas.

Source