Cubana Chief priest plead not guilty to Naira abuse charges

Cubana chief priest dey comot from court

BBC
Cubana chief priest

Popular socialite Pascal Okechukwu alias Cubana Chief Priest don plead not guilty to di charges wey di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC sama am ova naira abuse.

Cubana Chief priest bin appear for di Federal High Court for Lagos on Wednesday wia im plead not guilty to di charges.

Di court bin also grant am bail wey worth about N10 million wit two sureties.

Wetin happun for court

Cubana Chief priest appear early Wednesday morning for di Federal High Court in Ikoyi.

Im show for court wit im pipo and lawyers as dem waka go di courtroom wia di judge bin deliver di judgment.

Afta di court session wia im plead not guilty and dem grant am bail, Cubana waka from di courtroom go im car in di company of im lawyers.

Im stand beside im lawyer as e dey follow di media tok and im bin also dey greet pipo wey come show am solidarity.

Cubana Chief priest and im pipo

BBC

Why EFCC charge Cubana Chief Priest go court?

Nigeria anti-corruption agency, di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) drag Cubana Chief Priest go court ova accusation of naira abuse.

EFCC say dem file three count charges against Cubana Chief priest say im dey spray and tamper wit naira for different social event wey im go.

Di popular socialite go appear for court wa im go ansa questions ontop di allegations wey dem sama am.

EFCC tok-tok pesin Dele Oyewale bin tell BBC Pidgin say dem go arraign Cubana Chief priest for Lagos on wednesday.

“Yes, we dey arraign am for Lagos on Wednesday,” Oyewale tok.

Di anti-corruption agency tok say di action of Cubana Chief priest dey against di Central Bank Act of 2007 wey touch on spraying of money and abuse of di naira.

Di charges against Cubana Chief priest include say e ‘tamper wit N500 notes wey di CBN bin issue wen im bin dey dance for two hours for one social event for Eko Hotel on 13 February 2024 and im commit offence wey dey punishable under di CBN Act of 2007.’

Di agency also allege say Cubana Chief priest bin ‘tamper wit N500 notes wey di CBN bin issue wen im bin dey dance for two hours for one social event sometime in 2020 in Lagos and im commit offence wey dey punishable under di CBN Act of 2007.’

According to di third count charge, Cubana bin also ‘tamper wit N500 notes wey di CBN bin issue wen im bin dey one social event for January 2024 in Lagos and im commit offence wey dey punishable under di CBN Act of 2007.’

Dis dey come just few days afta di EFCC bin sentence ogbonge Nigeria celebrity Idris Olanrewaju Okuneye wey pipo sabi as Bobrisky to six months in prison for similar accuse.

For 2022, di EFCC bin arrest Cubana Chief Priest on charges wey border on alleged money laundering and tax fraud.

According to di report wey fly upandan, EFCC gbab am for Lagos airport.

About 48rs afta, di EFCC free Cubana Chief priest and im post for im Instagram page as im thank im followers wey send am messages.

Who be Cubana Chief Priest?

Cubana Chief Priest wey also call imsef Celebrity barman real name na Pascal Chibuike Okechukwu.

Im na business man wey get big investment for entertainment and showbiz – na im get Club Xhrine for Owerri, Imo state.

Dem born Cubana Chief Priest for Umuhu Okabia, Orsu Local Government Area of Imo state.

Na im be di second son of im parents wey train am for Aba, Abia state wia im learn shoemaking.

Cubana Chief Priest later attend Federal Polytechnic Nekede Owerri, wia im earn im first degree.

For early 2021, im bag degree in Doctorate of Science for Event and Luxury Hospitality Management from European American university – im announce di degree on im Instagram page on Saturday, April 24, 2021.

Cubana Chief Priest get wife and children.

Dem born Cubana Chief Priest for Umuhu Okabia,

BBC
Cubana Chief Priest salute im fans

Source