Why university students dey protest across America and why e bring back Vietnam War memories?

Police gbab one of di protesters

AFP

Hundreds of students for universities wey dey America don chop arrest sake of dia protest for different campuses.

Di universities don record a growing number of students wey dey waka comot class and some dey set up camps as a form of protests sake of wetin dem call di Israel military campaign for Gaza.

Dia protest dey connected to di Israel war against Hamas for Gaza and dem also dey condemn industries wey dey support di war wit weapons.

Di war bin start wen Hamas and dia gunmen carry out attack for Israel on 7 October, killing about 1,200 pipo wey be say na civilians plenti pass. Dem come take about 253 back to Gaza as hostages.

Hamas health ministry say dem don kill more dan 34,305 pipo for di war and many of dem na children and women.

Wetin di protesters want?

Na large crowds of protesters wey be students bin dey gada in dia increasing numbers for different universities for di US.

Dem don arrest hundreds of dem in di last two weeks. But wetin dem really want?

Many of dem dey say make universities stop to dey invest school funds into companies wey dey involved for di manufacturing of weapons for Israel war against Hamas for Gaza.

“Our university dey involved for dis kain violence, and na why we dey protest,” Columbia Students for Justice in Palestine bin write for X.

Many of di protesters wey set up camps in solidarity of di protest no gree comot di place even as di university authorities don warn dem.

From California to New York, different demonstrations dey go on and di police don make arrests wit about 108 pipo wey dem don carry enta police custody for Boston.

Di protesters dey tok say dia free speech dey silenced as some reports say hostility dey for di protest.

Some protesters no gree for police

Getty Images

‘Di protests bring back memories of Vietnam war’

As di protest dey go on, some pipo say e remind dem of di 1960s wen different demonstrations against di Vietnam War bin rock parts of di kontri.

For some observers, di protests for Columbia and oda US college campuses remind of di 1960s, wen demonstrations against di Vietnam War happun across di kontri.

One ogbonge professor of literature Marianne Hirsch say di Gaza war dey make am difficult to do business.

Di ogbonge professor bin participate for di Vietnam War wey happun from 1955 to 1975. Im tok say ‘pipo dey feel say di Gaza war dey unbearable and dem need to act.’

Anoda ogbonge pesin wey witness di Vietnam War and also witness how dem arrest plenti pipo for Columbia dat time, Oren Root, tell BBC say even as similarities dey for di Gaza war and Vietnam war, “di world dey different now. Di internet and social media na big factor,” Oren tok.

Im add say di internet dey help spread false narratives ontop di protest and e dey very unfortunate.

Na plenti military officers and civilians wey reach millions bin die for di Vietnam War.

How more dan 100 chop arrest, four police injured

Di protest wey don dey go on for long for Emerson College for Boston, Massachusetts bin result to how about 100 protesters chop arrest overnight.

About four police officers also injure for di protest. Police say none of di arrested protesters dey injured.

One student say di scene of di protest dey violent as police dey arrest pipo. Dem drag some pipo for ground as dem put dia hand for dia back and drag dem away,” one student tell CBS.

Dem get to cancel classes for di university on Thursday.

Texas Govnor Greg Abott say di protesters suppose dey jail.

Students dey protest

AFP

Which universities dey affected wit di protest?

  • For Atlanta, several dozen protesters wey no “dey affiliated” with Emory University set up tents for campus early Thursday morning, di school tok inside statement.
  • Administrators said the group of trespassers was later joined by members of the university community. But when the protesters refused to disperse, the Emory Police Department “took a couple dozen people into custody”.
  • The statement did not clarify how many arrests were made and which charges the suspects could face.
  • Emerson College, Boston – Di university don warn make di protesters comot but dem no gree and about 108 pipo don chop arrest.
  • University of Southern California’s Alumni Park – For Wednesday, police bin face di protesting students for dem to comot di camp wey dem don build and dem arrest plenti pipo.
  • University of Texas, Austin – Na ova 30 pipo don chop arrest from police on Wednesday as di police use bikes and oda equipment to chase di students back.
  • Columbia University, New York – Di protests bin begin from Columbia University, wia dem arrest more dan 100 pipo last week.
  • Harvard University, Boston – Di protesters make camp for di university and dey say dem no go comot until do goment meet dia demands.
  • Di California State Polytechnic University, Humboldt campus– Dem don close dis campus as di protesters dey occupy about occupy two buildings while work and classes go dey happun online.
  • For Washington, protest camps dey set up for Georgetown University and George Washington University (GW) and American University.
  • Dem don also carry di protests go places like Yale, MIT, Brown, Stanford and Johns Hopkins Universities.
Protesters for Columbia University gather

Reuters

Source