Who be Afronitaaa and Abigail di hearing impaired child dancer from Ghana wey impress judges for Britain’s Got Talent

Two female Ghanaian dancers dey trend afta dia amazing performance for Britain’s got talent audition wey happun on Saturday.

Afronitaaa wey be ogbonge dancer and seven year-old Abigail, wey no fit to talk or hear, don show di judges wetin dance choreography from Ghana dey look like.

Inside di nine-minute video wey go viral, Afronitaaa and Abigail do various moves to one of Ghana’s musicians wey dey di UK, Fuse ODG im azonto songs.

Afronitaaa wey im real name na Danita Yeboah tok bifor di show say “we wan make Simon Cowell smile wit our performance.”

Simon na pesin pipo sabi say na tough judge, im dey hard to impress during di Britain’s got talent show.

“We dey carry di Ghana energy come shut down di auditorium,” Afronitaaa tok bifor dia performance.

Im add say dem dey inside to “make history, to do am for Ghana.”

Na so dem dance wia di audience dey cheer dem on, some of di pipo dey shed tears as dem dey watch di two dancers for stage.

Even di judges too dey cry.

Simon Cowell and di three oda judges give dem standing ovation.

One of di judges, Amanda Holden tok say dis be “absolutely, insanely good. So joyous, so brilliant.”

Im also add say Afronitaaa and Abigail na “two of di most fantastic dancers we don see for Britain’s got talent show.”

For anoda judge, Bruno Tonioli, wetin di two Ghana dancers perform bust im brain.

“You two na dancing queens, your choreography na world-class,” im tok.

Afronitaaa tok say im carry di hearing impaired 7 year-old girl as im sister wey im wan mentor am well well.

Judge Simon Cowell tok say wetin Afronitaaa do na wonderful tin.

“Say you go be mentor for dis pickin na wonderful tori. If dis video comot, I believe say your life go change for better,” Simon add.

For pesin wey pipo sabi say na “mean judge”, dis performance don melt im heart to di point wey im tok say “dis na one of my favourite auditions dis year.”

Afronitaaa biography

Afronitaaa na dance artist and choreographer for Ghana wey begin dey dance professionally di time im dey 14 years.

Im dey part of dance group DWP Academy from 2018 bifor im decide to leave in 2024 to start im own dance academy for kids.

At 20 years, Afronitaaa don dey pursue business administration for di university of Ghana, wey im dey combine wit dance.

For di six years wey im dey dance, Afronitaaa get ova 6 million followers across im social media, wia im collaborate wit plenty brands and musicians for Ghana, Nigeria, Tanzania, Barbados, France, Dubai and di UK.

Afronitaaa say im dey “specialize for afropop wey be mixture of afrodance wit oda popular dance from oda genres.”

Abigail Adjiri 7-year-old hearing impaired dancer

Abigail Adjiri na winner of one talent show for Ghana.

Di dancer win TV3 Talented kids show for August 2023.

Despite say im no dey hear wey im no fit to talk, Abigail beat competition for dat show wey im win.

Dem born Abigail as deaf pesin.

But recently, im get hearing aid wey dey fit help am to hear small sounds inside one ear.

Im mama Evelyn tok say as im born Abigail, im neva cry, despite say di nurses don pinch am.

But dat time, im neva know say im pickin get any problem until say im chop one year.

“Abigail no respond to anytin afta one year, im neva fit to call mommy or daddy wey im also dey sleep even wit loud noise,” Abigail mama tok.

“Na so we go hospital wia dem tok we say my pickin no dey hear anytin wey im no dey fit tok.”

But wit im dance talent, Abigail don become national star afta im win di TV3 talent show.

Afronitaaa don become Abigail im mentor

Afronitaaa tok say im see some of Abigail im dance videos for social media wey im decide say im go find am.

“As I watch im videos, my spirit tok me say make I mentor dis girl. Na so we become dance duo.”

Since den, Afronitaaa dey teach Abigail plenty dance routines wey dem dey play shows together.

But how Afronitaaa dey teach pesin wey no fit to hear or tok?

Di dance artist explain say “Abigail neva understand sign language, but we dey communicate wit body movement and gestures.”

“She dey hear loud sound wit vibrations either from im feet or for im chest.”

Now, im hearing aids dey fit make Abigail hear small small sound inside im left ear.

Afronitaaa tok say, Abigail always get dream say im go one day perform for big stage like di Britain’s got talent show.

“For im iPad, im dey watch plenty audition videos from dis show, so I tok myself say I for try and make dis dream come true,” Afronitaaa explain.

“Also I wan make pipo know say disability neva be inability, once you get talent, make you no hide am.”

Afronitaaa dey hope to inspire many pickins say dem too fit make am, no mata dia challenge for dis world.

Wit im new kids academy, im dey hope to raise di next generation of dancers, one pickin at a time!

Source