Deaths recorded afta building collapse for South Africa

Di collapsed building

Reuters

Rescue teams still dey find survivors afta one five-storey building wey bin still dey under construction bin collapse and kill five pipo and trap at least 50.

Officials for di city of George for Western Cape province sat dem don comot 24 pipo from di building and carry dem go hospital.

Na 75 crew bin dey on site wen di building collapse on Monday afternoon.

Dem still dey investigate wetin cause di collapse from di coastal city.

Emergency services rush enta afta di building collapse for 14:09 local time (12:09 GMT).

Two out of di 24 pipo wey dem comot from di collapse bin die of dia injuries.

George Mayor Ald Van Wyk, “our thoughts dey wit di families and all di pipo bin dey affected and wey still dey wait to hear sometin about dia loved ones.”

More dan 100 rescuers wey carry sniffer dogs work throughout di night to comot pipo wey trap for di building. Dem also carry heavy lifting equipment to take help wit di operation.

Officials say dem don reach dey tok to some pipo under di building.

Foto dem don comot wey show as di construction site don flat finish as part of di roof dey on top.

Local councillor Theresa Jeyi tell Reuters news agency say, “I bin see as one guy dey work den ‘boom’, I come see as di whole building collapse … I also dey traumatized. E dey very sad.”

Meanwhile South Africa President Cyril Ramaphosa send condolence message to di relatives and friends of di five pipo wey die for di incident.

For di statement wey di tok-tok pesin to di President, Vincent Magwenya add say, “di president thoughts dey wit di families wey don lose dia loved ones and also di families of di close to 50 pipo wey dey trapped to di rubble.”

Di President also tok about di investigation into di tragedy say, e “must to aim to bring closure for di community and make so dat dis kain kasala no go happun again.”

Source