Fury vs Usyk fight – wetin to look out for in di fight of who go become di undisputed champion

Tyson Fury and Oleksandr Usyk

Getty Images

Tyson Fury and Oleksandr Usyk go jam inside ring for Saudi Arabia on Saturday for wetin dem dey call di sper fight.

Dis fight na to combine all di heavyweight championship belts for di first time in 24 years to become di undisputed heavyweight champion.

Broadcasters dey expect di match to start by 23:00 BST wit di Usyk-Tyson ringwalk for Saudi Arabia.

35 year old Fury na di WBC Champion and di 37 year old Usyk from Ukraine get di WBO, WBA, IBF and Ring magazine titles.

Fury don dey undefeated for 35 fights wit one draw while Usyk get 21 wins from 21 fights.

Wen Usyk bin dey di cruiserweight for boxing, e bin earn di title dia too for undisputed champion.

Fury wey dey ginger bin push Usyk for chest wey make security separate di two of dem as dem bin dey weigh in for di fight.

British Fury weigh in at 262 pounds wey be di lightest e don weigh in ova four years wey go give am ogbonge weight advantage.

Ukraine Usyk weigh at career heavy 224 pounds.

Di mata of size don turn serious conversation as di match don dey near so. Dis na as Usyk dey only two pounds heavier pass how e be wen e beat Anthony Joshua for 2022.

Fear also dey say Fury fit don lose too much weight wey fit affect how im go resist punches,

Earlier dis week di last pesin to be undisputed heavyweight champion wen dem bin dey run am wit three belts, Lewis bin point out say Fury resemble who lose weight for legs and dat one fit make am easier for pesin to knock am down.

Wetin be di difference for Fury and Usyk record?

Fury and Usyk both dey undefeated and di small stain wey dey Fury record na di draw e bin get wit Deontay Wilder for 2018.

Fury don get 34 wins and don produce four stoppages for im last five fights. E don get 24 stoppages for im career.

E don get all di workd title for di heavyweight division.

E beat Vladimir Klitchko for 2015 to bicon unified champion, but e neva get di four belts at once.

Usyk sef dey undefeated for 21 fights wit 14 stoppages. E don only get five fights for di heavyweight, and na for one e beat Anthony Joshua for 2021 to become unified champion for im third fight for di division.

E bin gbab di title of undisputed champion for di cruiserweight and bin go di Olympic, European and world champion for amateur level.

Even though dia recods match, Fury tall pass Usyk wit six inches and get seven inch reach advantage.

Source