Napkin wey Barca use promise Messi contract don sell for N1.4 billion

Lionel Messi on top field

Getty Images
Lionel Messi dey now play for Inter Miami for America

Di napkin wey Barcelona bin promise say dem go sign 13 year old Lionel Messi don sell for auction for £762,400.

Di starting price for di ‘standard Spanish waxy napkin’ wey dem laminate and frame na £300,000.

Di napkin wey dem sign wit blue biro for December 2000 bin get promise from di den Barcelona oga Carles Rexach to sign Messi.

Josep Minguella wey be transfer adviser for di Spanish club and agent Horacio Gaggioli wey recommend Messi follow sign di napkin.

Na Gaggioli give di napkin up for online auction by di London based Bonhams.

Messi join Barca one month afta dem agree dat deal and turn to dia top goal scorer sotay many pipo dey reason am as di greatest player of all time.

E start to play for di first team at di age of 16 and score a record of 672 goals for 778 games for di club.

Messi win 10 La Liga titles and four Champions League titles for Barcelona bifor im comot go Paris St-Germain for 2021. Di 36 year old World Cup winner now dey play for Inter Miami.

Dem sign di napkin for meeting wey Rexach arrange wey invite Messi papa Jorge to chop. Messi family bin dey fear say Barcelona no ansa dem afta Messi don do trial.

Di napkin contract tok say: “For Barcelona, for 14 December 2000 and for di presence of Messrs Minguella and Horacio, Carles Rexach, FC Barcelona sporting director, don gree under im responsibility and regardless of any opinions wey no gree go sign Lionel Messi as long as we keep to di amounts we don give.”

Di napkin wey dem write di contract

Reuters
Dis napkin cost £762,400

Ian Ehling wey be di oga of fien books and manuscripts for Bonhams New York tok say, “since dem first announce di sale, e don capture international attention and fans all ova di world don dey wait dis day.

“Na wonderful results for one of di most ogbonge items I don handle. Yes na just paper napkin but na famous napkin wey start Lionel Messi career.

“E change Messi life di future of Barcelona and dey behind wetin bicom some of di glorious moments of football to billions of fans around di world.”

Bonhams tok on top accuse of who own di napkin wey bin comot for March say dem “neva dey substantiated and e be like dem don comot am for recent press comment.”

Di auction house add say, “di consignor of di napkin don get legal ruling wey give dem say dem get right to sell di napkin under Spanish law, and e go give di seller full warranty of title wit di sale.”

Source