Why special prosecutor for Ghana dey face impeachment

Di special prosecutor for Ghana, Kissi Agyebeng dey face impeachment three years afta president Nana Akufo-Addo appoint am to replace Martin Amidu.

Kissi dey under pressure from some goment officials wey complain about how im dey do im job.

One ogbonge case di special prosecutor don handle na di mata wey involve former sanitation minister Cecilia Dapaah wia house-helps tiff im $1m and oda currency from im bedroom.

But wetin dey surprise plenti pipo na di fact say di pesin wey file petition to di president for im impeachment na im predecessor, Martin Amidu.

Oga Amidu don resign from dat office in 2020 afta im tok say di president and oda goment officials dey frustrate im work.

Na so Kissi Agyebeng replace am.

But oga Amidu don dey bash Kissi Agyebeng since im start to dey work for dat office.

Oga Amidu tok say Kissi Agyebeng dey abuse im office wit some of di tins im dey pursue.

In December 2023, oga Amidu wey dey call inserf citizen vigilante, tok say make di president fire im predecessor sake of “im attack di judiciary”.

Dis na afta Kissi Agyebeng do one press conference wey im lament say di judiciary no dey support im work as prosecutor, sake of dem strike out some of im corruption cases against public officials.

Oga Amidu tok say dat press conference “abuse di judiciary wey im bring dem to disrepute on top di eyes of di public”.

“Di press conference by Oga Kissi incite di media and di public against di judiciary wey im cross di red line of freedom of expression “, Martin Amidu add.

Five months afta dat write-up, oga Martin Amidu don petition di president to sack di special prosecutor Martin Amidu.

Wetin dey inside Martin Amidu petition

For di petition Martin Amidu write to di president, im tok say Kiss Agyebeng “breach procurement laws as im buy vehicles to run di office of special prosecutor”.

Im also allege say di special prosecutor violate di rights of citizens and oda goment officials thru arrest and detention during di time im dey investigate dem for corruption.

As oga Amidu tok in December, about di Kissi Agyebeng attack on di judiciary, im add inside di petition say “di prosecutor abuse judges and di court.”

Oda tins di petitioner tok be say Kissi Agyebeng appoint pipo to di office of special prosecutor without due process.

Oga Amidu believe strongly say di appointment of Kissi Agyebeng as special prosecutor na di worst appointment by di president.

“Di president neva fit to initiate disciplinary proceedings against di SP as im only fit to remove am from office under section 15 of di special prosecutor Act 959 by impeachment”, Martin Amidu tok.

How di president go treat dis kain petition

Afta Martin Amidu present dis petition wey im write on 30 April to di presidency, Nana Akufo-Addo don forward am to di chief justice.

Na so im for do am, according to di law.

Wen di president receive petition for impeachment of di special prosecutor, im get seven days to refer di petition to di chief justice.

Di chief justice also gatz to, within thirty days, determine if prima facie case dey inside di petition.

Afta di chief justice determine say case dey inside di petition, im go within fourteen days, set up committee to investigate di mata within 90 days.

Di committee go involve one chairperson, wey be justice of di Supreme Court, one lawyer of at least fifteen years at di bar and one other pesin wey sabi investigations.

Di chief justice go forward di recommendation of di committee to di president, wia im go take action on am.

Di chief justice Gertrude Torkonoo don alreadi write to di special prosecutor Kissi Agyebeng for im comments on di allegations oga Amidu don make against am.

Ogbonge cases di special prosecutor don handle

In January dis year, di special prosecutor hand ova investigation into di financial affairs and assets of former sanitation minister, Cecilia Dapaah, to di economic and organized crime office (EOCO).

Di OSP in August last year, seize plenti money ($590k, GHC 2.7m) from di home of di former minister wia dem also find $5m and GHC 48m transaction value inside two of im bank accounts.

Di OSP also find GHC 1m in investments and GHC 700k cash inside im oda accounts.

In November 2023, di high court throw out di OSP im report wey accuse two former commissioners at di Ghana revenue authority of wrongdoing.

Di prosecutor accuse Colonel Kwadwo Damoah and Joseph Adu-Kyei say dem use dia position to “grant favourable tax treatment to Labianca food company wey belong to one member of di council of state, Jacqueline Asomah Hinneh”.

But di court rule say di special prosecutor go beyond im mandate to make adverse findings against di two public officials at di Ghana revenue authority.

Di special prosecutor reject di ruling of di court at di time wey im describe di decision as “inimical to di fight against corruption”.

Dis two cases na wetin trigger di special prosecutor to do dat press conference wey im tok say wetin di courts dey do wit di cases im dey carry go bifor dem, no dey help im work.

Source