How eight years old girl survive bus accident wey kill ova 40 pipo for South Africa

Di bus crash through one barrier on di bend in di road

BBC
Di bus crash through one barrier on di bend in di road

Forty-five pipo don die for South Africa afta di bus wey dem bin dey inside jam one 50m (165ft) bridge fall inside ravine, authorities tok.

One eight-year-old girl, di only survivor, sustain serious injuries but she don dey stable condition.

Di bus crash through barrier and catch fire wen e hit di ground for north-eastern Limpopo province.

Dem don carry Thirty-four body from di scene but na only nine bodies dey identifiable, authorities trok.

Di passengers travel for pilgrim from Botswana capital, Gaborone, to Easter service for di town of Moria.

Di vehicle lose control and go off di bridge on di Mmamatlakala mountain between Mokopane and Marken, around 300km (190 miles) north of Johannesburg, according to South African public broadcaster SABC.

Department of Transport tok-tok pesin Colin Msibi tell di BBC Newsday programme say di girl wey survive dey currently “for hospital, dem tell me say she dey in stable condition”.

“Wetin we suspect be say wen di bus hit di barrier of di bridge, di girl dey thrown out of di bus, and na so di girl take survive,” Mr Msibi tok.

Rescue operations search late Thursday evening and continue di next morning.

Limpopo health official Phophi Ramathuba tell South African broadcaster eNCA say body parts from separate crash victims fit don merge togada in di fire, na why be say na only nine bodies we don identified.

Transport Minister Sindisiwe Chikunga, wey go di scene of di incident, extend her “heartfelt condolences to di families affected by di tragic bus crash”.

She say di South African goment go help send back di bodies and hold full inquiry into di cause of di crash.

“Our thoughts and prayers dey wit you during dis difficult time,” she add. “We continue to call for responsible driving at all times wit heightened alertness as more pipo dey on di roads dis Easter weekend.”

South Africa get poor road safety record.

Ms Chikunga tell eNCA say di road di bus fall from dey “winding wit sharp bends, road wey I no fit advise any pesin wey dey drive wit heavy vehicle such as bus, such as truck, make dem use”.

Botswana President Mokgweetsi Masisi offer im “deepest condolences” to di pilgrims’ relatives, as well as di church wey dem belong to, following di “heartbreaking” crash, one statement from im party tok.

Di office of South African President Cyril Ramaphosa also put out one statement on Thursday evening, saying di leader express sympathy for Botswana and di victims’ loved ones.

For one Easter message wey dem release before di crash, Mr Ramaphosa don ask citizens to “do our best to make dis Easter safe”.

Make e no be “time wia we go sit back and wait to see statistics on tragedy or injuries on our roads”, im add.

Source