EFCC drag Godwin Emefiele go dia custody afta im plead not guilty to abuse of office

Godwin Emefiele appear for court

BBC

Former govnor of di Central Bank of Nigeria Godwin Emefiele don plead not guilty to 21 out of di 26 wey di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) charge am for.

EFCC charge Emefiele go court ova case of abuse of office and allocation of billions of US dollars.

Di anti-corruption agency drag di former govnor of di Central Bank of Nigeria (CBN) go court ova alleged abuse of office and allocation of US dollars.

Emefiele show face for court on Monday afta EFCC drag am ova 26-count charges. Im appear bifor Justice Rahman Oshodi of di Ikeja High court.

Emefiele dey arraigned wit Henry Omole wey be anoda suspect.

E dey face charges wey include say im abuse office for Lagos between 2022 and 2023.

Former CBN Governor Godwin Emefiele

BBC

Wetin be some of Emefiele offence for dis charge?

According to di EFCC prosecutor wey file di charges, Rotimi Oyedepo (SAN), Emefiele bin allocate “foreign exchange wey reach di sum of $2.1 billion witout bids and e dey against di rights of Nigerians”.

One of di count charges be say im allocate “$291,945,785.59, witout bids, and e dey against di rights of Nigerians”.

For same similar offence, dem say im allocate di sum of $1,769,254,793.16 and $370,872,893.01 for separate time witout bids.

Dem say Emefiele co-defendant Henry bin commit offence wey include say im accept di sum of $110,000 from one agent on behalf of Emefiele as gifts say im allocate foreign exchange in dia favour.

EFCC say all di offences wey Emefiele bin allegedly commit wit im co-defendant dey against Section 73 of di 2011 Criminal Law of Lagos State.

Court no gree for Emefiele

Di two defendants Emefiele and Henry bin plead say dem no dey guilty of di charges wey EFCC sama dem.

Justice Oshodi no grant di bail application wey di defendants bin apply for.

Emefiele lawyer Abdulakeem Labi-Lawal bin plea bifor say make dem grant am bail till di time wey dem go determine di whole gbege for di cases, but court no gree.

Di lawyer wey dey represent Emefiele, Labi-Lawal say make di court consider how im client dey always obey any order wey dem sama am.

Im add say Emefiele dey on bail wey di high court for Abuja bin grant am sake on im ongoing trial for anoda case.

Emefiele lawyer say im client (Emefiele) no dey miss any court appearance wey dem sama am and im dey honour everi invitation wey EFCC sama am.

Im plead say make di court look all dis actions of Emefiele and im position as di number one pesin for CBN and make dem allow am go on bail.

Di court no gree release am on bail as dem set anoda date to hear im application.

EFCC drag Emefiele go court

BBC

Afta pleading not guilty to di charges, di judge adjourn di case go Thursday 11 April.

Court say make dem put Emefiele co-defendant for prison till dem go come back for Thursday.

Afta di court session, EFCC gbab Emefiele put for inside dia bus wey carry am come as dem no allow am go on im own.

Emefiele appear inside one ash-coloured suit wit lilac shirt wey im wear under di suit as EFCC officers bin guide am enta inside dia white bus.

Emefiele stay for sometime inside di white bus for di court premises bifor dem drive am comot.

Di former CBN govnor bin comot court around 10:10am but not until 10:56am bifor dem drive am comot for di court premises.

For 2023, di federal goment bin charge Emefiele wit illegal possession of arms wey court say na offence wey dey contrary to Section 4 of di Firearms Act, Cap. F28 Laws of di Federation 2004, and punishable under Section 27 (1b) of di same Act.

Dem also claim say Emefiele violate Section 8 of di Firearms Act Cap F28 Laws of di Federation 2004 and punishable under Section 27 (1)(b)(il) of di same Act.

For same 2023, federal goment say Emefiele bin illegally buy 43 vehicles between 2018 and 2020 wey worth N1.2 billion.

Dem also accuse Emefiele say im award contract for di procurement of 37 Toyota Hilux Vehicles wey di worth enta N854 million, but e deny am.

Afta Emefiele bin spend 100 days for custody of Nigeria goment security agencies, di High Court of di Federal Capital Territory, on Wednesday 8 November 2023 grant am bail.

Na since di end of 2022 Emefiele begin enta news for some of im policies wey no go well wit Nigerians, allegations of abuse of office and illegal financial transactions.

One of dis policies na di naira redesign policy wia im bin give deadline wen pipo go stop to use di old naira notes as Emefiele tok say dem suppose to dey change naira notes evri 5-8 years.

Di policy also restrict pipo on how much dem fit withdraw from bank as cash.

For inside di same policy, Emefiele say pipo no go fit withdraw pass N20,000 naira a day from ATM.

Na plenti of dis mata Emefiele still dey face for court as im dey enta one case dey waka enta anoda one.

Source