Kenya don begin torchlight crash wey kill military chief

Kenya government don send one team to investigate di helicopter crash wey kill military chief Gen Francis Ogolla and nine odas.

E neva clear wetin cause di crash.

Gen Ogolla dey among di 12 pipo wey dey di military aircraft wey go down on Thursday afternoon shortly afta e take off for di north-west of di kontri.

Dem don fly di body of those wey die for di accident go Nairobi and di two survivors still dey collect treatment for hospital.

Family of di four-star general tok say dem go bury am on Sunday for im house for western Siaya county.

President William Ruto say di deaths na “moment of great sadness” for di kontri and e announce three days of national mourning,

Profile of Gen Francis Ogolla

Chief of Kenya Defence Forces General Francis Ogolla (C) salute as Britain King Charles III (unseen) and Kenyan President William Ruto (unseen) land di tomb of di Unknown Warrior during a wreath laying ceremony for Uhuru Gardens for Nairobi on October 31, 2023.

Getty Images

Kenya President appoint Gen Francis Ogolla as di kontri Chief of Defence Forces for April last year.

Oga Ruto describe im chief military adviser as gallant officer wey die for di line of duty.

“Our motherland don lost one of her most valiant generals, gallant officers, service men and women,” Oga Ruto tell kontri pipo.

Gen Ogolla first join di Kenya Defence Forces on 24 April 1984, according to di Kenyan defence ministry website.

E suppose mark 40 years for di military next week.

E start im career as 2nd lieutenant for di kontri air force, wia e train as a fighter pilot wit di US air force, di ministry says.

Di late general also train for di imagery intelligence, counter-terrorism and accident investigation.

For 2018, e become commander of di air force.

For one interview for May 2023, Oga Ruto tok say im appoint Gen Ogolla as di army chief “against di advice of many pipo”.

Di president say Gen Ogolla bin dey among one group wey try to influence di 2022 presidential election results.

Dis na di first time wey Kenyan military chief go die for office. Gen Ogolla dey due to retire next year.

Di oda nine senior military officers wey die for di crash na Brig Swale Saidi, Col Duncan Keittany, Lt Col David Sawe, Maj George Benson Magondu, Capt Sora Mohamed, Capt Hillary Litali, Snr Sgt John Kinyua Mureithi, Sgt Cliphonce Omondi, and Sgt Rose Nyawira.

Kenyan opposition leader Raila Odinga describe di crash as a “terrible day for Kenya”.

Moussa Faki Mahamat, chair of di African Union Commission, say im “thoughts and prayers” go out to Kenya president, government and pipo following di “tragic helicopter accident”.

Wetin we know about di helicopter crash

President Ruto say di helicopter crash around 14:20 local time (12:20 BST).

Di Kenya Air Force don send air investigation team to establish di cause of di crash, di president tok.

Di helicopter crash for Elgeyo Marakwet county, some 400km (250 miles) north-west of di capital Nairobi.

Authorities despatch rescue and recovery teams go di site of di crash.

Di president appoint Gen Ogolla April 2023, afta e serve as Commander of di Air Force and Deputy Chief of Defence Forces.

Oga Ruto describe Gen Ogolla – Kenya highest ranking military officer and di chief military adviser to di president – as officer wey dey gallant, e die for di line of duty.

“Our motherland don lost one of her most valiant generals, gallant officers, service men and woman,” Oga Ruto tell kontri pipo.

Di kontri go observe three-day period of mourning, starting from Friday, 19 April. Di flags for di Republic of Kenya and for Kenyan missions abroad go fly at half mast, Oga Ruto tok.

Di only two wey survive dey for critical condition and dey undergo treatment.

Di officers bin dey travel go Kenya North Rift region, wey banditry attack dey worry.

Dem bin dey on a mission to reopen some of di schools wey dey closed following bandit attacks.

Dem bin also visit military officers wey dem deploy to stabilise di region.

Source