Di life and times of Nollywood veteran Zulu Adigwe wey die

Zulu Adigwe, veteran nollywood actor, don die, according to sources from di Actors Guild of Nigeria.

Pipo wey dey aware of dis development confam to BBC Pidgin say Adigwe die afta im don sick for some time.

Also, di AGN National Secretary, Abubakar Yakubu confirm to tori pipo say oga Adigwe don pass on true true, even though e no give details.

Adigwe death dey come just weeks after di demise of a number of star actors for nollywood, including Obumneme Odonwodo, wey pipo know as Junior Pope; Amaechi Muonagor, and John Okafor alias Mr Ibu.

A star since 1987

Zulu Adigwe become household name for Nigeria in 1987 wen e play ‘Mr B’ for di popular sitcom ‘Basi and company’.

E also play di role of ‘Professor Monday Edem’ for di sitcome ‘Checkmate’ in 1991.

Wen home movies become popular wit di premier of ‘Living in Bondage’ in 1992, Adigwe follow for di most prominent faces for Nigeria movie industry.

Im don star for countless movies, wia e dey usually play di role of big man, chief, village king, etc.

First class brain, teacher, actor, musician

Born in Enugu, South-East Nigeria, Adigwe do im primary and secondary school abroad.

E study French and German languages and even work as a teacher bifor e come back Nigeria aftA im papa die.

E later go University of Ibadan to study Theatre Arts and graduate wit First Class.

For one interview wey e grant in 2006, Zulu Adigwe narrate how im bin get admission and start to dey study Medicine for Austria bifor di death of im papa.

Adigwe also narrate im journey wit music and how im first musical compilation bin no later see di light of day sake of money disagreement between di company wey sign am, and di oyibo investors wey put money for di company.

“As a matter of fact, about three years ago (2003), e get dis Nigeria National Arts Festival, and for dis particular year di topic na Music. Na for Abuja.

“Dem invite me to handle di whole thing for di Abuja entry. I no study music but I handle am well. Out of di 18 states wey dey represented, my contingent win gold,” e tok for dat interview.

In 2024 alone, actors wey don die for Nollywood don pass half a dozen, wey make di President of the Actors Guild of Nigeria, Emeka Rollas, tok say dem go invite one popular man of God make e hold fasting and prayer sessions for dem “to seek divine intervention”.

A Catholic knight of di order of Knights of St Mulumba, Adigwe bin tok how e wan to be remembered: “I believe say an artiste dey to serve humanity. Although pipo dey say ‘I wan be star so I go make money’, but for me, money dey secondary. I wan get something wey I go contribute to humanity.”

And according to tributes wey don dey pour in from Nigerians across di social media, Zulu Adigwe true true contribute something valuable to humanity during im life time.

Source