With four matches to go, any surprise fit still happen for di EPL?

Di 2024 EPL trophy don turn two-horse race between Arsenal and Manchester City

Getty Images
Di 2024 EPL trophy don turn two-horse race between Arsenal and Manchester City

Football sabi pipo dey in agreement say e go take a miracle for di 2024 English Premier League trophy to go to Arsenal as di season remain only four matches to end.

Di Gunners dey currently top di league table with 77 points, but dem don play one match more dan Manchester City who dey breathe down dia necks wit 76 points.

Liverpool bin wan make am a three-horse race, but dem slip up last Wednesday afta dem lose 2-0 nil to Everton for di Merseyside derby, and so remain for 74 points.

If City eventually become champions, e go be di second consecutive year wey Arsenal go lose di trophy afta dem don dey on top di league table for several weeks.

Tottenham fit decide am

Ange Postecoglou and Son Heung-min

Getty Images
Tottenham dey fifth place for EPL table, but dem still need to play Arsenal, City and Liverpool as dem dey fight to qualify for di Champions League next season.

Di three of Arsenal, City and Liverpool still need to face fifth-placed Tottenham before di season go end, and sabi pipo dey tok say na dis tie go decide who go be champions.

Tottenham dey follow Aston Villa for di league table, but dem don play two matches less dan Unai Emery boys, which mean say dem still get eyes for dat fourth position wey go guarantee dem a place in di Uefa Champions League next season.

Di Spurs fit still qualify for di Champions League if dem finish fifth – sake of di proposed expansion of di tournament from 32 to 36 teams – but Ange Postecoglou don tok say im team go fight to get di final automatic qualification spot.

Tottenham go host Arsenal on Sunday, April 28, den travel to Anfield di following week, before dem go receive Manchester City on May 14.

For Arsenal, dia remaining fixtures dey more tricky on paper, dan di oda teams wey dem follow dey drag di first position. Asides from Tottenham, di Gunners go still face in-form Bournemouth, Manchester United, and an Everton side wey dey fight to avoid relegation.

On di oda hand, only Tottenham be di remaining fixture wey fit shake City, going by dia current form. Dia oda matches na against Nottingham Forests, Wolves, Fulham and West Ham.

Former Everton defender, Leon Osman, however tok say im dey root for Arsenal to lift dis year EPL trophy.

“I know say everybodi go dey expect say na Man City go carry di cup, but I think say Arsenal still get chance for dis one. I do. I bin no expect dem to be here for dis stage, if you look at how strong dem be, dem don beat teams five and six nil, dem don go Man City and get di result dem want. Dem get slip up for Aston Villa, wey I think say e come at di wrong time, but I really think say dem still dey for dis race,” Osman tok.

For Ian Wright wey be former Arsenal record goal scorer and currently EPL pundit, e dey hard to see City dropping any points for dis stage “but I dey pray say somebody fit make am happen”.

Source