Wetin you suppose know about Chad presidential election

Chad dey run dia presidential election on 6 May wey go end di three year transition period.

Di chairmo of di National Election Management Agency (ANGE), Ahmed Bartchiret na im make di announcement say di election go hold on Monday.

E also add say initial results go comot by 21 May and final results go drop by 5 June.

Voting don start wit some comma as some voting polls open ova one hour afta voting suppose start.

Di transitional President Mahamat Deby tok as e dey vote say e dey proud say e don fulfil im promise to respect di deadline for “elections wey go mark di return to constitutional order”.

Eight million voters dey expected to vote from among ten candidates wey include di military leader Mahamat Deby and im Prime Minister Success Masra.

Tori be say if dis election no comot clear winner, runoff elections go hold on 22 June.

Who be di candidates wey dey run

Mahamat Idriss Deby

Gen Mahamat for im army fatigues

Getty Images
Gen Mahamat bin take ova power afta im papa sudden death as dem dey fight rebels for 2021

40 year old Mahamat na di candidate for di United Chad coalition wey claim say dem get ova 200 parties inside.

E dey popularly known as Gen Kaka and e bin turn general for 2010. Until im papa die, e bin dey work as di oga of di presidential guard wey dem call, Directorate-General of di Security Services of State Institutions (DGSSIE).

Mahamat, at first bin promise say e go run 18 month transition to civilian rule as di head of Transitional Military Council (CMT).

Mahamat bin increase im rule by anoda two years wey cause deadly protest wey rights group say kill at least 200 pipo and put ova 1,000 more for prison.

Im campaign platform na wetin im call “12 projects – 100 actions” wia im promise to promote, peace and national reconciliation. E also promise say e no go run “Deby Dynasty”.

Succes Masra

Succes Masra on top motor dey campaign

Getty Images
Succes Masra don deny say e go share power wit di junta if im win

40 year Masra bin dey named as prime Minister for January by Gen Mahamat.

Dis one bin come afta di deal wey di DR Congo President Felix Tshisekedi bin arrange afta di October 2022 protests.

E go run under di Transformers Party wey e bin form for 2018. Di Supreme Court bin no gree am make e run for di 2021 presidential election and e still dey call out di Deby family rule.

Opposition don call out im recent candidacy say e wan run on behalf of Mahamat but e say e no get any plan to share any power wit am.

Im campaign promise wey e tok give France tori pipo for April na say, “I wan be di head of solid state of Chad, a reliable partner wey France fit work wit. And for dis reliable partnership wey I wan develop, some tins go dey for di past century.”

Bifor im join politics, Masra bin work as economist for di African Development Bank (AfDB).

Albert Pahimi Padacke

Albert Pahimi Padacke

Getty Images
E bin work as prime minister wit di two Debys

Veteran Politician, Padake go run under di National Rally of Chadian Democrats – Revival (RNDT-Le Reveil) party.

E don contest against Idriss Deby in presidential elections for 2006, 2011, and 2021.

E bin work as prime minister for Deby administration from 2016 to 2018. But e also serve as interim prime minister for Mahamat from April 2021 to October 2021.

Di 57 year old don call out wetin e call friendly match between Mahamat and Masra say dem be “threat to di unity of Chad”.

E bin oppose di new constitution and don promise to “restore democracy” if dem elect am.

Lydie Beassemda

Lydie Beassemda

Getty Images
Lydie Beassemda bin make history as di first female presidential candidate of Chad for 2021

50 year old Beassemda na di only woman wey dey contest for dis election.

She be di leader of di Party of Democracy and Integral Independence (PDI) since 2018 wen di founder and her papa, Beassemda Djebaret Julien die.

For 2021, she become di first eva female presidential candidate for Chad and come third for polls wit three percent of di votes.

Beassemda don hold ministerial posts from 2018 to 2019 and again from 2021 to 2022.

Her campaign proposals include to create federal state and also to modernise agriculture and strengthen di kontri education system.

Source