Who be actor Mpho Sebeng wey die

Mpho Sebeng

Getty Images

Tributes still dey pour come for di South African actor, Mpho Sebeng wey die on Sunday.

Di 30 year old actor by die for car accident for Potchefstroom for North West province, as im family bin confam for statement.

Fellow actor Zola Hashatsi bin tok about how sad e be for Sebang death.

E post for social media say, “Na wit sad, deep, and painful heart to announce di passing of one young broda, friend wey I take in to replace us wen we don go.”

Di state media house SABC say dem bin dey “saddened by di untimely death of di actor.”

Dem say, “im ogbonge contribution to di entertainment industry no go ever dey forgotten”.

Netflix South Africa post for X say, “A life well lived. Rest in peace Mpho Sebang.”

Sebang na ogbonge actor for South Africa wey don dey act for lmost 20 years.

E start to act for television at di age of 12 years old.

E bin act for di TV Drama wey dem dey call Justice For All and Zero Tolerance wey win plenti awards.

And as e enta high school like dis, e come act for di 2011 feem Winnie, wey be tori of di life of late Winnie Mandela.

E also get acting roles for di Netflix shows wey dem call Savage Beauty and Miseducation.

E bin collect nomination for Best Male Actor for di 2018 South African Film and Television awards.

Mpho Sebeng

Getty Images

Dem born Sebeng for December 1992.

According to di Owen S. Management, Sebeg family friend bin advise am to act afta e see am for one school play wet im do for primary school.

Im first television show na Justice for all and Zero Tolerance wey go on to win plenti awards.

E go on to act as Bongane for Bay of plenty, e act for one short feem wey dem call Khandakulu and Scandal.

Im most ogbonge role for di 2011 feem Winnie see am rub shoulders wit Hollywood stars like Jennifer Hudson and Terrence Howard.

Im first major lead role for primetime TV for di show Ring of lies na im get am im 2018 nomination for Best male Actor for Telenovela for di South African Film & Television awards.

E also collect nominations for Best Supporting Actor for di 2017 Africa Magic Viewers Choice Awards AMVCA for di feem, The Jakes are Missing.

And for 2022 e get nomination for di Best Supporting Acor role for di IDYLLWILD.

For im 18 year run, e don act for about 16 television shows and 0 movies.

Source