Family comfam death of former education minister Kenneth Gbagi

Family of former education minister Kenneth Gbagi don comfam say di politician don die at di age of 62.

According to one statement im eldest son Emuoboh Gbagi sign, di former minister die on Saturday 4 May.

“Na wit profound sadness but gratitude to God we announce di passing of our beloved father, grandfather, husband, and brother, Olorogun Kenneth Omemavwa Gbagi, former Minister of Education, wey leave dis world 4th of May 2024 at di age of 62,” di statement tok.

Gbagi bin serve as di minister of state for education under di administration of former President Goodluck Jonathan.

E also be di governorship candidate of di Social Democratic Party (SDP) for di 2023 election for Delta state.

Kenneth Gbagi profile

Dem born Kenneth Gbagi for Sapele for September 1961 for Delta State, south-south Nigeria.

Im early years no dey too smooth as e struggle to send imsef go primary and secondary school.

After im secondary education, Gbagi bin work wit one foreign service bifor e travel go abroad to further im education. As e dey for Hong Kong, im shoot one movie for 1993, di moni wey dem pay am for im work na im e take further im education go university.

E study Political Science for one of di oldest university for di world, Sans Thomas University, and Criminology from Philippine College of Criminology.

Gbagi later come back Nigeria and work wit Police College for Ikeja, wia e teach criminology.

E later go back school to study law for di University of Lagos.

Gbagi na industrialist and e get plenty investments wey include hotels.

For 2022, Delta State Police Command bin declare Gbagi wanted on top accuse say e strip some staff of im hotel naked.

Four pipo wey say dem be staff of Signatious Hotel, Warri Delta State, south-south Nigeria bin accuse di owner, wey be di former minister say e strip dem naked, parade and accuse dem say dem tiff im moni.

Di four pipo bin demand justice for di humiliation dem allegedly suffer.

Di commissioner of police bin invite Oga Gbagi on September 25th, 2020 for questioning on top di alleged dehumanising incident but e no show up.

Meanwhile di owner of Signatious Hotel Warri bin deny di accuse say e strip and parade im staff naked.

Kenneth Gbagi tell BBC Pidgin at di time say notin like dat happun and di tori na political nonsense against im govnorship ambition.

Gbagi wey be former minister of state for education say dose pipo no be staff of im hotel but pipo wey dem catch dey swim illegally for im swimming pool and dem turn out to be robbers.

Source