Tinubu appoint governing council members for Federal institutions – wetin be dia work?

Nigeria goment don appoint new Pro-chancellors, Chairmen, and members of governing Boards of Federal institutions for Nigeria.

According to di document wey dey for social media, Nigeria President Bola Tinubu confam di appointment for over 50 Federal Universities as each university get one Pro Chancellor and five members. for di list. Polytechniques and oda federal colleges get governing boards.

Dis dey come afta di National Universities Commission (NUC) bin beg di Academic Staff Union of Universities (Asuu) to calm down as federal goment bin dey try to reconstitute di governing councils for universities.

Na Executive Secretary of NUC, Chris Maiyaki, tell tori pipo for one interactive session for Abuja , Nigeria capital.

Oga Maiyaki bin also beg Asuu to trust di ability of goment and di Minister of Education, Tahir Mamman, to reconstitute di gverning councils of di 61 federal universities.

According to local media Asuu bin dey para say dem no go fit endure again as goment no wan put new governing councils for public universities.

Who fit be members of governing councils

Di governing council mostly dey made up di Chairman wey di President of Nigeria go appoint.

Oda members na di Vice-Chancellor di University, di Deputy Vice-Chancellor, di Registrar, and oda ogbonge pipo from different fields.

According to one online publication’ Composition and Tenure of Governing Councils of Federal Universities under Nigerian Laws’ wey Prof Ehi Oshio, Dean Faculty of Law University of Benin write, im explain how e take start.

Im tok say na from di Universities (Miscellaneous Provisions) (Amendment) Act 2003, wey dem dey also call di Universities Autonomy Act, wey di National Assembly enact and signed into law on 10th July 2003 by President Olusegun Obasanjo e come but dem bin push am go corner for some years.

Im explain say na recently dem discover say e dey exist and e dey powerful enough to resist di first attempt by di Federal Goment to constitute Councils wit

excessive membership wey dey contrary to di provisions of di Act.

Under di Act, members of di Governing Councils of universities, di membership fit be two different ways wey be: Ex-officio members and non-ex-officio members.

External members and Internal members. Di members fit be di folloowing according to di tertiary institution.

  • The Pro-Chancellor
  • The Vice-Chancellor
  • Deputy Vice-Chancellors
  • One pesin from di Federal Ministry wey dey responsible for Education;
  • Four pipo wey dey represent different interests.
  • Federation to be appointed by the National Council of Ministers.
  • Four pipo wey di Senate go appoint from among dia members.
  • Two pipo wey di Congregation go appoint from dia members .
  • One pesin wey di Convocation go appoint from among e members.

Wetin be di work of governing councils

Di governing council na di highest policy and decision making body for tertiary institutions.

Dis institutions include: Univeristies, Polytechnics and Colleges of Education.

Dem also dey incharge of how di university management dey go.

Dem dey also oversee di academical direction of universities to make sure say e dey work in compliance wit dia vison and mission.

Dem dey also make sure say di school no break any regulatory rules.

One of dia main duties na to bring policies and make decisions wey go affect di institution.

Di policies concern academic, administrative, and financial issues.

Na dem go approve di budget of university evri year.

Dem go supervise di employment of staff and and promotion.

Dem go also approve new academic programs, and make sure say di university dey inline wit dia goal and objectives.

Dem dey also make sure mago-mago no dey inside di appointment of Vice-Chancellor.

Special Adviser to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga post full list of members of di governing councils of Federal tertiary institutions wey President Bola Ahmed Tinubu approve for im X handle.

According to di list, University of Lagos Pro Chancellor and Chairman na Wole Olanipekun SAN.

Wole Olanipekun na di lead counsel to di ruling All Progressives Congress for di 2023 Presidential Election Petition Court.

Di Pro Chancellor of University of Port Harcourt na Prof Peter Okebukola

Prof Jubrila Dahiru Amin na di Pro Chancellor and Chairman of University of Abuja.

Prof Mohammed Mana na di Pro Chnacellor and Chairman of di Univerity of Ibadan governing board.

Col Ahmed Hammanga na di chairman of Univeristy of Nigeria, Nsukka, Enugu state.

Source