South Africa ex-minister Pravin Gordhan die at di age of 75

Pravin Gordhan

Getty Images

South Africa former finance minister, Pravin Gordhan, don die at di age of 75, im family tok.

Di anti-apartheid veteran don dey for South African politics since 1994 wen di kontri bin dey transition to democracy.

E bin occupy strategic positions for di South African goment until e announce im retirement from politics in May.

Di ogbonge cabinet minister die early Friday for hospital afta “a short, courageous battle wit cancer”, im family tok for one statement.

Dem tok say e bin dey “surrounded by im family, closest friends and im lifelong comrades for di liberation struggle” wen e pass away for di early hours dis morning”.

E leave behind im wife Vanitha and dia daughters Anisha and Priyesha.

Cyril Ramaphosa mourn Pravin Gordhan

South Africa President, Cyril Ramaphosa say di passing of lifelong activist and former Minister of Public Enterprises Pravin Gordhan pain am well-well.

Oga Ramaphosa give im deep condolences to Mr Gordhan wife, Ms Vanitha Raju and im entire family.

For statement wey tok-tok pesin for di Presidency Vincent Magwenya sign, e tok say, “Di President thoughts dey wit di former Minister Gordhan and im extended family, comrades, associates and organisations wey im establish relationships wit as a family and community member, freedom fighter, public sector executive and Member of the National Executive.”

Di statement add say im contribution to public sector start from im involvement for di anti-apartheid struggle, wey include im role for student and civic movements for di 1970s and ‘80s, as executive member of the Natal Indian Congress and military operative for di armed wing of di African National Congress.

During South Africa transition to democracy and for di early years of di new dispensation, Mr Gordhan bin play a leading role for di Convention for a Democratic South Africa (CODESA) multi-party dialogue and dem later appoint am as Chairperson of di Parliamentary Constitutional Committee.

“Pravin Gordhan personal sacrifices and im endeavours and achievements for various sectors of our society give am plenti insights, empathy and resilience wey ginger im service to di nation.

“As we mourn im passing, we remain grateful for im life of sacrifice and service and as im kontinu to strive for di realisation of di vision and dictates of our Constitution,” President Ramaphosa tok.

“We put im family for our thoughts and prayers at dis time.”

Who be Pravin Gordhan?

Pravin Gordhan na political activist from im teenage years, and im join di struggle against di racist and oppressive system of apartheid and joined di ANC’s underground structures for di 1980s.

Im be one of di negotiators for di kontri peaceful transition to a constitutional democracy and become a member of parliament for 1994 afta Nelson Mandela become di country first democratically elected president.

Gordhan last position in goment na as di minister of public enterprises from 2018 to 2024 in charge of state-owned enterprises.

E bin serve two terms as finance minister from 2009 to 2014 and again from 2015 to 2017.

From 1999 to 2009, Gordhan na di head of di South Africa Revenue Services, and dem hail am say im transform am into a world-class tax and customs service.

Gordhan na outspoken critic of corruption in goment and state-owned enterprises, and na one of di ministers wey criticize di leadership of former President Jacob Zuma wen im still dey serve for im cabinet.

Source