Tyrese Haspil wey kill im oga Gokada CEO Fahim Saleh chop 40 years in jail

Manhattan judge don sentence former personal assistant of Fahim Saleh to 40 years imprisonment for di murder of im oga, young tech CEO of Gokada.

Di 25-year-old American man, Tyrese Haspil, dey guilty of first-degree murder, grand larceny, burglary, and concealment of deadibodi.

Haspil go turn 61 wen im serve im jail term complete – e bin commit di crime wen e dey age 21 in 2020.

Di court sentence Haspil for 25 years on murder and 15 years for di embezzlement of $400,000 from di deceased, breaking into im apartment, and dismembering di deadibodi.

According to di Manhattan press release, Haspil try cover up im crime depsite Saleh generosity.

Di attorney tok say dis go give Saleh family closure even though di sentence no fit bring dia son back.

“Today, Tyrese Haspil dey face accountability for brutally murdering and decapitating Fahim Saleh, kind, generous, and empathetic person wey impact di world. Even afta di defendant steal from am to fund im lavish lifestyle, oga Saleh still give am second chance,”District Attorney Bragg tok.

“While today sentence no fit bring Saleh back, I hope e go provides im family sense of closure as dem kontinue to mourn im painful loss.”

Tyrese Haspil dey for defense table at Manhattan court and foto of Fahim Saleh

Getty Images/@fahims/Instagram

On July 13, 2020 Haspil enta Salah lobby wit knife and taser, e wear black mask so Saleh no go recognise am. E den enta di apartment and follow Saleh inside di elevator wia im stab am for neck and kill am.

Haspil spend months to plan di murder.

Haspil try to cover di murder e use mini vacuum to vacuum di Anti-Felon Identification Discs (AFID), wey contain serial number and discharged by di Axon taser to aid law enforcement.

E return to di apartment di next day, afta e don throwaway di evidence for dustbin, e dismember Saleh body wit saw and clean up di crime scene.

Wen Haspil go buy battery for di saw, Saleh cousin enta di apartment to check since she neva hear from am for 24 hours. Inside di apartment, she discover her cousin body and call di police.

Wen Haspil return from Home Depot, e notice police presence for Saleh apartment and leave di scene.

On July 17, 2020, officers arrested Haspil at di Airbnb im book to celebrate im girlfriend birthday.

Who be Fahim Saleh?

Dem born di 33 year old businessman for Saudia Arabia to Bangladesh parents and later na im all of dem come relocate enta New York, America.

E start to dey develop love for coding and all dat kain tin wen e be teenager.

Fahim Saleh na techpreneur wey start Nigeria okada hailing service, Gokada for 2018.

But no be dat time e start to dey work on di tech space. For 2009 after e graduate from Bentley University for Massachusetts, United States of America, e start di app PrankDial, wey be app wey dey make random prank calls give different pipo.

Gokada for Lagos, Nigeria no go be di fist ride sharing company wey im create as im also create Pathao for im home kontri of Bangladesh for 2015.

Tori be say di ride sharing app wey dey valued at about $100 million na di biggest ride sharing app for di kontri.

Source