Medical report show how husband of Kristina Joksimovic Miss Switzerland finalist kill her

Tori of how former model and Miss Switzerland finalist, Kristina Joksimovic die don emerge.

Dem find di bodi of di 38,-year-old for dia house in Binningen, near Basel, Switzerland, in February.

Medical reports say e get oda tins wey her husband do to her deadi body afta e kill her.

Her husband na di papa of her two pikin.

Di 41-year-old admit say im kill her in March, according to di Federal Court in Lausanne, according to 20mins, one local media for Switzerland.

E claim say im dey act in self-defence, afta she bin attack am wit knife, tori wey different from di findings of di medical forensic report.

Di report add say afta di suspect pour sometin for her deadi bodi.

According to investigations di suspect “kill im wife and attempt to cover up di crime”. On Wednesday, court ruling find say di suspect bin strangle Ms Joksimovic to death.

Di public prosecutor office also reveal say di suspect violently kill her.

Authorities detain Thomas afta dem discover di model body in February but im bin tell investigators say im do tins to her body out of “panic afta im discover her dead”.

Di suspect later claim say im kill her in self-defence but investigators tok say e show “obvious high level of criminal energy” in dia assessment.

Investigator say im show “lack of empathy and cold-bloodedness afta killing im wife” and add say e get “sadistic-sociopathic traits”.

Di couple happily marry for 2017 but dem dey get marital issues. Di couple don call police to dia residence bifor di incident ova report of physical violence.

Four weeks bifor she die, Ms Joksimovic share on social media of “couple getaway” for one luxurious hotel wit dia two young daughters.

Ms Joksimovic win Miss Northwest Switzerland and participant in Miss Switzerland competition in 2007.

Afta competing, Ms Joksimovic launch her coaching career to coach oda models and beauty pageant contestants.

Source