Why Senegal President Bassirou Diomaye Faye dissolve National Assembly

Senegalese President Bassirou Diomaye Faye don dissolve di National Assembly and set new date for early parliamentary elections.

For one national address wey dem show for television on Thursday 12 September, 2024, President Dioma Faye announce say im don dissolve di National Assembly.

“By virtue of di powers wey I get, by article 87 of di Constitution, and afta I consult wit di Constitutional Council on di right date, di Prime Minister and di President of di National Assembly on di appropriateness, I dey dissolve di National Assembly.

Di date of di legislative elections go be on Sunday 17 November 2024,” President Diomaye Faye announce.

Wetin be President Faye reasons?

Dis announcement dey come sake of kasala wey dey happun between di Executive and di parliamentary majority.

Dis na mainly di MPs of Benno Bokk Yakaar (BBY), wey don result to di rejection of one draft on constitutional revision.

Di aims of di draft na to abolish di High Council of Territorial Authorities (HCCT) and di High Council of Local Authorities.

“I dey dissolve di National Assembly to ask di sovereign pipo for di institutional means wey go enable me to give substance to di systemic transformation wey I bin promise dem,” President Faye tok to justify im decision.

Di announcement of di dissolution come on di eve of Prime Minister Ousmane Sonko appearance bifor Parliament for im general policy statement.

Di political wahala between di executive, wey be minority for di National Assembly, and di opposition, wey get majority for parliament, don make di atmosphere dey filled up wit bad belle.

Dis kasala between di two groups dey block goment action sometimes and e don raise fears of institutional crisis.

“Unfortunately, di parliamentary majority don decide to go against di will of di Senegalese pipo, wey dem bin clearly express on di evening of 24 March 2024.

“Firstly, dem no gree hold di budgetary orientation debate on 29 June, 2024 wey bin dey compulsory on di grounds of a supposed attack on di political terrain.

“Dis violation of a legal obligation wey dey inside article 56 of di organic law on finance laws go don seriously contribute to tarnishing Senegal image for di eyes of international institutions,” President Faye tok.

“Secondly, as dem reject di draft of di constitutional amendment on Thursday 29 August 2024, wey dey aimed at fulfilling di promise I bin make to di pipo to abolish di High Council of Local Authorities (HCCT) and di Economic, Social and Environmental Council (CESE), at a time wen di state of public finances urgently need to manage public spending,” President Faye add.

Di president continue im televised speech: “Finally, dem go too far takeover di constitutional right of di President of di Republic to set a date for di Declaration of General Policy, and na serious violation of Article 84 of di Constitution and Article 97 of di Organic Law on di Rules of Procedure of di National Assembly.”

“Not to mention di threat of a motion of censure wey dis majority dey hang over di goment,” e add.

Atfa dem elect am for di first round of di presidential election on 24 March 2024 sake of di promise of a break wit di past and profound change, President Faye don set new date for di next legislative elections for 17 November.

Dis dey in accordance wit di Constitution, wey set di limits (a minimum of 60 days and a maximum of 90 days afta dissolution of parliament).

According to President Faye, di purpose of di dissolution na to clarify di democratic process and give am stable majority to govern di pipo

Source