Osun election: Buhari react as Ademola Adeleke defeat Oyetola to emerge govnor-elect

Nigeria President Muhammadu Buhari don congratulate di candidate of di opposition PDP party, Senator Ademola Adeleke, as im win Osun govnorship election.

President Buhari say di election show wetin democracy really dey about, respect for di will of di pipo.

Im hail di successful conduct of Osun election as a demonstration of di maturity and di commitment of all stakeholders, towards strengthening di integrity of di electoral process for Nigeria.

Buhari add am say im dey fully committed to leave behind a legacy of credible elections for Nigeria.

Ademola gbab four hundred and three thousand, three hundred and seventy one vote to lead im rival and present govnor of di state Gboyega Oyetola.

Atiku, Saraki also react to Adeleke win for Osun

“Light don come to Osun”, dis na di reaction from presidential candidate of di People’s Democratic Party, Atiku Abubakar.

E congratulate di governor elect and also hail all di pipo wey come togeda to make di winning possible.

“Mostly dis na congratulations to di pipo of Osun state”, e tok.

Former speaker of di Senate and PDP chieftain, Bukola Saraki say Oga Adeleke really understand di lessons from 2018- wen im first come out to contest- and work to build stronger coalition across di state and di kontri.

Saraki say di party go copy dis winning strategy for di general election wey go happun for 2023.

Adeleke, 62, poll 403,371 votes to defeat im closest rival and present govnor of di state Gboyega Oyetola wey poll 375,027 votes.

Dis na di second time wey di two politicians go dey go head to head for election.

Dem first meet for 2018 wen Oyetola defeat Adeleke afta Inec declare di election inconclusive sake of say di marging wey Adeleke take beat Oyetola no reach di numbers of votes wen dem bin cancel.

Five tins to sabi about Senator Ademola Adeleke

  • Ademola Adeleke na di younger broda of di first civilian govnor of Osun state, Late Senator Isiaka Adetunji Adeleke.
  • Dem elect Ademola as senator representing Osun west senatorial district for 2017 to complete im elder broda tenure for di senate. E n o be politician befor befor, but political analyst believe say plenti pipo vote am sake of im big broda good will for di state.
  • Im papa na Nigeria senator and im mama na prophetess
  • Ademola be uncle to Nigeria superstar Davido. Davido papa , Adedeji Adeleke na Senator Ademola big brother. Na Adedeji dem born after di late Adeleke. E get one big sister as na im be di last born of im parent.
  • E graduate wit Bachelor of Science degree in criminal justice for 2021 from Atlanta Metropolitan State College for United States afta e dey involved wit one certificate scandal wey see am charged to court.