Afcon 2025 qualifiers table, fixtures and results

Ivory Coast beat Nigeria 2-1 for final to win

Getty Images
Ivory Coast na di reigning African champions

Di qualifiers for di 2025 Africa Cup of Nations wey go happun for Morocco start dis week.

48 national teams across di continent dey take part for dis campaign.

Di confederation of Africa (Caf) divide di teams into 12 groups, dem go den battle am out in a series of matches, 24 matches dey scheduled for the opening day.

Na di top two finishers for di 11 groups wey no involve tournament hosts Morocco, go qualify for di competition.

24 teams go compete di 35th edition of di ogbonge football competition wey go hold between 21 December and 18 January.

Dis qualifiers go tough especially wit teams like reigning champions Ivory Coast, and African giants Egypt, Nigeria, and Senegal, Algeria.

See di full schedule for Day 1 of Afcon 2025 qualifiers and results

Group A

Afcon 2025 qualifiers table

BBC Sport

Group B

Afcon 2025 qualifiers table

BBC Sport

Group C

Afcon 2025 qualifiers table

BBC Sport

Group D

Afcon 2025 qualifiers table

Getty Images

Group E

Afcon 2025 qualifiers table

BBC Sport

Group F

Afcon 2025 qualifiers table

BBC Sport

Group G

Afcon 2025 qualifiers table

BBC Sport

Group H

Afcon 2025 qualifiers table

BBC Sport

Group I

Afcon 2025 qualifiers table

BBC Sport

Group J

BBC Sport

Group K

Afcon 2025 qualifiers table

BBC Sport

Group L

Afcon 2025 qualifiers table

BBC Sport

Wednesday, September 4, 2024

Sudan 1-0 Niger

Comoros 1-1 Gambia

Tanzania 0-0 Ethiopia

Libya 1-1 Rwanda

Thursday, September 5, 2024

Malawi 2-3 Burundi

Central African Republic 3-1 Lesotho

Congo 1-0 South Sudan

Ghana 0-1 Angola

Guinea-Bissau 1-0 Eswatini

Algeria 2-0 Equatorial Guinea

Tunisia 1-0 Madagascar

Friday, September 6, 2024

Kenya vs Zimbabwe

South Africa vs Uganda

DR Congo vs Guinea

Sierra Leone vs Chad

Togo vs Liberia

Morocco vs Gabon

Cote d’Ivoire vs Zambia

Egypt vs Cape Verde

Mali vs Mozambique

Senegal vs Burkina Faso

Saturday, September 7, 2024

Cameroon vs Namibia

Mauritania vs Botswana

Nigeria vs Benin

Morocco dey prepare to host Afcon for di second time

As di qualifiers for di Africa Cup of Nations Morocco 2025 start on Wednesday, di North African nation prepare to host di continent ogbonge football tournament for di second time for dia history.

Di first time Morocco bin host di Africa Cup of Nations na 1988, 36-years afta di kontri don see ogbonge development for dia football.

For 1988, di tournament bin feature just eight teams and na Cameroon win am.

Di 2025 edition, 24 nations go take part, dis go reflect di growth of African football.

Many pipo dey tip key cities like Casablanca, Rabat, Marrakech, and Tangier to host di matches next year.

Tori be say di iconic Stade Mohammed V for Casablanca, wey bin host di 1988 final, fit play central role again.

Morocco hosting of Afcon 2025 go further confam di kontri as big force for football on and off di pitch.

Di nation successful bid to host di 2030 Fifa World Cup, jointly wit Spain and Portugal, show say dem get big dreams.

Source