President Ruto announce date for school resumption afta Kenya floods

Di president of Kenya Williams Ruto don finally announce date wey school children go resumption for di kontri afta flood scatter dia plans.

Di president tok di new resumption date during im meeting wit grassroots pipo wey Kajiado Central MP Elijah Memusi and im Laikipia North counterpart Sarah Lekorere bin lead come di state house.

Im say schools for Kenya go reopen next week.

President Ruto bin previously announce further postponement of school children resumption during im national address wey im give for di state for di kontri capital, Nairobi for 3 May 2024.

According to President Ruto, im say schools for Kenya go dey closed till further notice sake of di floods.

But im don announce a new date for resumption.

Wen Kenya schools go reopen

On Wednesday 8 May 2024, President Ruto tok during di say make parents dey prepare dia children to return to school.

Im add say di goment don make arrangements and repairs for di classrooms and e go dey ‘safe’, according to local media report.

“All parents dey advised, on di assessment of weathermen and di goment of Kenya”, e go dey safe.

We don make adequate arrangements, we don ask Members of Parliament and we don provide resources through NG-CDF for repair of classrooms and other learning facilities across Kenya”.

Di president of Kenya say schools go reopen next week Monday – 13 May.

“All schools go dey opened on Monday next week and diafor parents gatz prepare dia children to go to school,” President Ruto tok.

Di president confam im meeting wit di grassroot pipo for im X page on Wednesday wia im appreciate di parliament members wey lead di pipo come.

“We applaud di Kajiado Central MP Elijah Memusi and im Laikipia North counterpart Sarah Lekorere for dia courage to rise above partisan politics and agree to work wit us becos na di time for us to unite and transform Kenya togeda,” president Ruto tok.

Foto of flooded street for Kenya

Getty Images

Di Kenya ministry of education bin postpone di reopening of schools across di kontri due to di flooding.

Inside one statement for April, Cabinet Secretary of di ministry Ezekiel Machogu say dem go postpone di second term by one week due to di heavy rain, wey don affect some schools in di kontri.

Primary and secondary schools wey suppose open on Monday, 6 May 2024 don dey further postponed.

Later, di president postpone di school reopening till further notice until dem fit handle di floods.

Tins President Ruto tok during di national address

Foto of Kenya president, William Ruto

BBC

President Ruto tok say di floods wey sweep through Kenya claim about 210 life for di kontri.

“Di weight of di tragic event wey happun in recent weeks don test di nation resilience for challenges. Persistent rain don cause devastating floods wey don claim 210 life as of today,” Ruto tok.

Di president tok how di flood don case serious wahala for di kontri.

“E don also cause injuries and cause katakata for our infrastructure and life of di pipo. No corner of di kontri escape, school resumption dey postponed and transportation don become challenges sake of di floods.”

Relocation plans and IDP camps

President Ruto also add say make local authorities begin di reconstruction of schools wey di heavy rainfall and floods don destroy since March.

Also, im tok say make dem begin di evacuation of pipo wey dey live for risk flooding areas and dem don serve relocation notice to pipo.

“Di kenya army, police and oda security agencies dey directed to deploy operations to safeguard pipo and evacuate dos wey dey for high risk area.”

“Goment don map out 178 dams and water reservoir within private and public county. Areas wit landslide dey mapped as high risk and pipo gatz dey relocated.”

Di president add say dem “don give relocation notices to pipo wey dey live for settlement, river, streams and oda water places”.

According to di Kenya president, di goment don set up 115 internally displaced pesin camps across di kontri and e go host about 27,587 pipo wey dey affected by di flood.

Slum settlements dem build on land wey dey prone to flooding

EPA
So far, ova 180 pipo don die sake of di heavy rains and floods

Foods and shelters for Kenyans

Plenti affected pipo no see food to chop and no place to live in. Kenyan goment say dem don plan how to provide food and non-food essentials for dose wey di floods really affect.

“Di goment don put in place plans to provide shelters, foods and non-food essential supply to support every affected pesin. Goment don partner to make food available for pipo wey dey affected.”

President Ruto say dem neva see di last of dis period as di situation dey expected to escalate and report say di rain go continue in high volume for di rest of dis month and possibly afta.

“Di climate agency don issue warning say Kenya fit face dia first eva cyclone wey fit hit anytime.”

“E go cause heavy rain, strong wind and dangerous waves wey fit affect di kontri. And our kontri gatz act fast to save life and properties,” Ruto tok for di state address.

Source