Arsenal vs Everton, Man City vs West Ham live – Premier league final day live updates

Premier league 2024 live updates

Getty Images

Di 2023/2024 season of di Premier League go end on Sunday.

Di season go get dramatic end sake of say di league neva get clear winner.

Three -time champions go play dia last match in front of home fans and dia home support fit give dem advantage to flog West Ham.

Manager, Mikel Arteta wey im side dey pursue Man City wit just two points, go become champions fo di firt time since 2004, if dem beat Everton.

If Pep Guardiola men draw and Arsenal win, di two teams go finish wit 89 points and di Gunners go start di final day wit a slim goal difference advantage of +61 over City +60.

Guardiola tok say: “Di destiny dey for our hands, but if you dey tink say dem go drop, you dey wrong. If you dey tink say Everton go do somtin, forget about am. I don see Arsenal throughout di season.

“We just dey focus on wetin we get to do against West Ham. No contamination dey my brain about any oda tin, we need to do wetin wey get to do to beat West Ham.”

Arsenal boss Arteta tok say: “Di magic dey already happun becos dis na wetin evri football supporter want and live for, dem want make e go down to di last game.

“Di last minute of di Premier League for di level, di most beautiful league for di world by far wia you get two teams. Dis na wetin you want, dis na why na di most competitive league for di world.

“As pipo no fit predict am e be like drug. You still dey dia, you still need to earn am and e no sure for anybody. Plenti factors dey wey fit which can change tins around very quickly but wen you manage to do am, e dey phenomenal.”

We go bring live updates and scores from di matches and live commentary of di matches between Man City vs West Ham and Arsenal vs Everton.

Man City vs West Ham preview

Manchester City

Manchester City fit become di first team for English top-flight history to win four league titles back to back.

Na nine times wey di Premier League reach di final day before dem know di winner and City bin win all di last four.

Manchester City dey on a club-record run of 43 back to back home games witout City na di only team wey neva lose any Premier League home game dis season, dem win 13 and draw five.

Pep Guardiola bin don win 11 league titles in 11 out of 14 top-flight seasons as a manager – im win three for Barcelona, three wit Bayern Munich and five wit Manchester City.

Erling Haaland don score 63 goals for 65 Premier League games – di highest of any player for im first two seasons for dis division.

Rodri dey unbeaten for each of im last 73 City appearances, im win 57, draw16 since di 1-0 Premier League defeat by Spurs for February 2023.

West Ham United

West Ham lose dia last two Premier League away games, dem concede five times for each defeat.

Dia 3-1 win over Luton last weekend na dia fourth top-flight victory dis calendar year. Dem draw 7 and lose.

West Ham neva keep clean sheet for dia past 17 league outings, na dia worst run since dem go 24 matches without a shutout for 2008.

Di 71 goals wey dem bin don concede dis season na dia highest for Premier League campaign – one more dan di 2010-11 season wen dem bin finish bottom of di table.

David Moyes don ready to take. charge of im 262nd and final match as West Ham manager. Im bin din win 112 matches, drawn 55 and lost 94 of im past 261 games.

Dey refresh dis page for live updates

Source