Former American footballer OJ Simpson die at di age of 76

Foto of OJ Simpson for Lovelock Correctional Center in Lovelock, Nevada

Getty Images
Foto of OJ Simpson for Lovelock Correctional Center in Lovelock, Nevada

OJ Simpson, di former American footballer wey dem clear of murder, don die at di age of 76, im family tok.

Orenthal James Simpson rise to fame as college footballer bifor e begin play for di NFL.

For 1995, dem clear am of di murder of im former wife Nicole Brown and friend for one trial wey hold for America.

For 2008, dem sentence am to 33 years imprisonment on charges of armed robbery. Dem release am for 2017. Dem convict am for im role for one robbery on di Las Vegas hotel room of two sports memorabilia dealers.

Simpson die of cancer on Wednesday 10 April, im family write on Twitter/X.

“On April 10th, our papa, Orenthal James Simpson, surrender to im battle wit cancer.

“E dey surrounded by im children and grandchildren.

“During dis time of transition, im family beg una make una respect dia wishes for privacy and grace,” di statement tok.

For February, reports say doctors dey treat Simpson for prostate cancer, and fans show concern about im health afta dem see foto wey show as im dey waka slowly wit hunchback

Two months ago – on di day of di Super Bowl – Simpson post video ontop im X account, and tell im supporters: “My health dey good, clearly I dey deal wit some issues but hey, I tink say e go soon dey ova and I go return to golf course – hopefully for couple of weeks,” im tok.

“But e dey veri nice to hear from una and hearing dose good, positive words.”

OJ Simpson show court leather glove allegedly used in di murders

Getty Images
During di trial, OJ Simpson wear leather glove wey im allegedly used for di murders

Who be OJ Simpson?

Bifor 1994, di public love Simpson, na professional athlete, actor and million-dollar tok-tok pesin for several US companies, wey pipo sabi wella.

But dat year, dem arrest am as suspect for murder of im ex-wife Nicole Brown and friend Ron Goldman.

Di trial shock di nation and im acquittal di following year dey controversial. Di trial na one of di most notorious for di 20th Century America.

E become one of di greatest ball carriers in NFL history. For 1973, im become di first NFL player to rush for more dan 2,000 yards for one season. Im retire for 1979.

For 1969, e become pro and dem draft am into di National Football League by di Buffalo Bills. Among di hundreds of players wey enta di NFL draft, Simpson dey di first overall pick.

Im play wit di Bills from 1969 to 1977, during dis time e win plenti awards, and on multiple occasions lead di NFL for rushing yards and rushing touchdowns.

Source