Why Bayern Munich suspend and fine Sadio Mane

Sadio Mane

Getty Images
Sadio Mane and Leroy Sane bin dey argue wit each oda during Tuesday’s game

Bayern Munich don drop Sadio Mane out of dia squad for dia Saturday league match against Hoffenheim.

Di German club say di reason why dem drop Mane na sake of wetin dem call player’s “misconduct”.

Reports for Germany dey allege say Mane punch im team-mate Leroy Sane for face.

Dem claim say di incident happun afta dia Tuesday 3-0 Champions League defeat for Manchester City.

According to reports na dia teammates separate di players afta dia fight for Etihad Stadium.

Bayern don confirm say dem go fine di Senegal forward too.

Bild say di former Liverpool player Mane, wey be two-time African footballer of di year, bin complain about di way Germany winger Sane bin speak to am afta di defeat.

Afta im fly back to Germany, dem pick up Mane privately for airport while Sane follow di team bus.

Neither Mane or Sane don comment on di alleged fight.

Bayern go host City for di quarter-final second leg next Wednesday.

‘Mane cross line’

Di reports of Sadio Mane allegedly punching im Bayern Munich teammate, Leroy Sane for face dey ‘shocking’.

BBC sport Journalist Joshua Adetunji tok as im address di Senegalese suspension for Bayern Munich.

According to Joshua di reason why di tori dey shocking na sake of say nothing like dis bin happun throughout Mane stay for Liverpool.

Even for Southampton wia e join Liverpool from sef.

‘’People know Mane to be an easy going and a cool headed player’’. Joshua tok.

One German tabloid, Bild bin report say Mane allegedly vex wit Sane ova how im speak to am afta dia defeat by Manchester City.

‘’If truly dat na di case, e no justify physical assault on your teammate no matter di provocation.’’ E add.

‘’I feel say Mane cross di line if truly im punch Sane for face,’’ Joshua continue.

Like dem dey tok, you no fit retaliate for sport. Even, beyond sports, any form of assault dey condemnable.

Dis no be good behaviour for a two-time African footballer of di year, wey many pipo see as role model not just footballers.