Kontri wia serious hunger dey waya nearly 18 million pipo as civil war kontinu

One elderly man wait to refill im donkey-drawn water tank during one water crisis for Port Sudan for war-torn Sudan on 9 April, 2024.

Getty Images
Di war don push Sudan pipo to di brink

One year don pass since conflict break out between di Sudanese army and paramilitary Rapid Support Forces (RSF), wey plunge di kontri into a civil war.

Di violence bin start for di capital Khartoum and don spread across di kontri, and e don cause di deaths of thousands of pipo, as well as widespread of destruction of buildings and infrastructure.

One senior UN official tell BBC Arabi say Sudan don become di world worst hunger crisis.

“We get a catastrophe for our hands and my fear be say e go get even worse,” Michael Dunford tok. Im be di emergency coordinator for Sudan for di World Food Programme (WFP).

Nearly 18 million pipo dey “acutely hungry” and dis figure fit go much higher, e add.

Aid experts also warn say 220,000 pipo fit die in di coming months.

WFP Regional Director for Eastern Africa Michael Dunford tok to one family wey run across di border into South Sudan.

WFP/Gemma Snowdon
Michael Dunford na also di WFP Regional Director for Eastern Africa and e dey meet Sudanese families displaced by di crisis inside and outside di kontri.

Di fighting bin start for 15 April 2023 wen tensions between di kontri army and dia former RSF ally explode into di open.

Di spark na internationally-backed political plan to move towards civilian rule.

Experts fear say di official UN figure of nearly 14,000 dead dey too low, wit di real figure likely do dey much higher.

More dan eight millions don dey forced to run comot from dia homes, wit many internally displaced while odas don run across di border to Sudan neighbours.

A historic city in ruins

Di capital Khartoum, along wit di adjoining cities of Omdurman and Bahri, make up Greater Khartoum. Na home to ova seven million pipo bifor di war.

Di RSF control large parts of di city but di army don dey on di offensive and recently take control of di state TV headquarters in Omdurman.

Photos and videos wey BBC Verify and BBC Arabic assess show damage to shops, hospitals, universities and banks.

Destroyed buildings include di iconic Greater Nile Petroleum Oil Company Tower, wey dey engulfed in flames last September.

This picture taken on 17 September, 2023 shows a raging fire at the Greater Nile Petroleum Oil Company Tower in Khartoum.

Getty Images
Di Greater Nile Petroleum Oil Company Tower na major landmark

At least three hospitals and one university don suffer varying levels of damage sake of di clashes.

Dr Alaa El-Din El-Nour from Khartoum tell BBC Arabic say hospitals bin dey face serious shortage of medical supplies.

“We no feel safe as doctors. Medical supplies and equipment don also dey looted,” e tok.

Di WFP tok say di destruction of infrastructure dey worsen di humanitarian situation.

“E dey intensify di levels of food insecurity,” Mr Dunford add.

BBC Verify and BBC Arabic don collate further examples of damage for Khartoum wey dey contribute to di humanitarian crisis.

Shambat bridge

BBC

Shambat Bridge, wey link di cities of Omdurman and Bahri, bin collapse last November. Na strategic site for di RSF wey dey use am to move fighters and equipment across di Nile river.

For January, di al-Jaili oil refinery, wey dey north of Khartoum, catch fire afta reported fighting. Di facility don dey at di centre of a power struggle between di warring sides.

Leon Moreland, one researcher at di UK charity, di Conflict and Environment Observatory, tok say 32 large storage tanks don dey damaged for three separate incidents between November 2023 and January dis year.

“Oil leaks fit reach groundwater and agricultural areas downslope towards di Nile witout intervention,” e tell BBC Arabic.

“Dis new pollution go worsen pre-existing ground contamination for di site, wey satellite imagery suggests dey already extensive.”

Oil refinery

BBC

Satelite images also show say di storage tanks for three water pumping tanks for Khartoum dey empty. E no clear how dis one take happun.

Hassam Mohammed, one 31-year-old for Khartoum, tell BBC Arabic say e don dey struggle wit water and power cuts for four months now.

E say, “we dey waka fo far to get clean water or we go use river water wey we no fit drink as e dey spread diseases.”

Water pumping station

BBC

Flights for Khartoum International Airport bin dey suspended for di start of di war afta e become a major battle ground, wey impact di delivery of aid within di kontri.

BBC Verify don authenticated several videos from di airport in di opening 48 hours of di conflict.

Khartoum International Airport

BBC

Di first video wey BBC Verify see na from 15 April wey come from di north part of di runway wia dem sight RSF dey run through di tarmac and shoot gun near di main airport buildings.

Soon afta, heavy smoke start to dey comot from at least one plane wey bin dey burn for di north end of di runway.

Anoda video show di ground level view of di planes, wey fit be di same ones wey bin dey burn for di first video but dis time dem dey di eastern side of di airport.

Di army and RSF don collect accuse sat dem scata important infrastructure for Khartoum but dem dey carry di blame give each oda.

E no be like say e go soon end

Fighting dey also happun for oda parts of Sudan, especially for di west, wey don get years of kasala between dia African and Arab communities.

Recent research from di Centre for Information Resilience wey be research group wey UK goment dey fund, dem find out say e pass 100 villages for western Sudan wey dem don burn.

One picture wey dem take on 20 March, 2024, show children wey run comot for Khartoum and Jazira states dey play near tents for one camp for di internally displaced for southern Gadaref state for Sudan.

Getty Images
Unless ceasefire dey, children go struggle to survive

Wael Fahmy, wey be Sudanese economic analyst, tok say di effect of di war on di economy and di food system don cause big kasala.

E say, “Di economy don reduce by half and like 60% of agricultural activity don stop.”

Di WFP sef no get hope.

“Wetin dey happun for Sudan today na absolute tragedy. We dey see now say e don pass be careful,” Michael Dunford tok.

Plenti international attempts to negotiate ceasefire don fail, though renewed push for toks dey for di Saudi city, Jeddah.

Additional reporting na by Samira Elsaidi & Benedict Garman

Source