Why Miss Teen USA and Miss USA resign dia position inside di same week

UmaSofia Srivastava and Noelia Voigt dey look at di camera, both of dem wear shine-shine dresses, sashes and Noelia wear crown

Getty Images

Miss Teen USA don resign her title, just days afta Miss USA bin step down.

UmaSofia Srivastava announce di news for Instagram, say her “personal values no longer fully align” with di pageant organisation.

E come afta one earlier announcement from Miss USA Noelia Voigt, wey cite mental health struggles as di reason wey make her drop di crown.

The Miss Teen USA organisation say dem support UmaSofia decision and say dem go announce who go take ova.

“Afta months of thinking about di decision, I don make di choice to resign from di title of Miss Teen USA 2023,” UmaSofia tok for her statement.

She say she “go always look back on my time as Miss NJ Teen USA fondly” and say di “experience of representing my state as a first generation, Mexican-Indian American at di national level bin dey fulfilling in itself”.

UmaSofia come explain say her “personal values no longer fully align with di direction of di organisation”.

BBC Newsbeat bin approach Miss USA organisation for further comment.

Earlier dis week, Miss USA Noelia Voigt bin announce her resignation, say she believe in making decisions “wey feel best for you and your mental health”.

“Prioritise your mental health, advocate for yourself and odas by using your voice and never be afraid of wetin di future hold, even if e no clear,” she bin write.

Fans online notice say di first letter of each sentence of Noelia resignation statement bin spell out “I AM SILENCED” – though di final three sentences spell “HIP”.

Miss USA thank Noelia and tok for Instagram say “di well-being of our titleholders na top priority”.

And no be di just pageant queens don recently comot from di organisation.

Noelia resignation come three days afta Miss USA social media director, Claudia Michelle, announce her own exit from di brand, citing alleged “workplace toxicity and bullying” and say make di titleholders “dey heard and not silenced”.

“I don get di privilege of getting to work with Noelia closely and unfortunately don see how her mental health go down since we first meet,” she tok.

Miss USA bin tell USA Today say Claudia statement contain “false accusations”, and say di organisation bin dey “committed to providing a safe, inclusive and supportive environment, and we take these allegations seriously”.

Miss USA bin don cause controversy over di treatment of contestants, with allegations of contest rigging – wey she deny.

For 2021, Max Sebrechts, one Miss USA vice-president, resign im role afta more dan one contestant alleged say e bin sexually harass dem.

Source