Harry Kane dramatic crash as Dortmund and Real Madrid set up Champions League final for Wembley

Champions League final

Getty Images

Na surprising end as Real Madrid steal two goals for late minutes wey di Champions League semi-final match wit Bayern Munich suppose end.

Real Madrid snatch di incredible semi-final victory on Wednesday night afta dem beat German giant Bayern Munich.

Real Madrid secure a 4-3 aggregate win against Bayern.

Wit dis win, Real Madrid don set diasef up for a Champions League final wit Borussia Dortmund.

Sadly, during di second leg of di semi-final match Bayern bin dey lead Real Madrid but tins begin fall apart for di 88th minute wen Joselu equalise from a great strike from Vinicious rebound.

Wen Harry Kane still dey ontop di pitch, e be like say Bayern Munich still dey head go di Champions League final.

Alphonso Davies first put Bayern ahead for di 68th minute afta Kane give am a superb pass.

Unfortunately, dat joy cut short sake of one costly mistake from Bayern goalkeeper Manuel Neuer wey give Joselu a chance to put di ball behind di net.

Heartbreak for Kane

Real Madrid vs Bayern

Getty Images

England midfielder Jude Bellingham dey happy for an incredible first season for Madrid but im go now face im former side Dortmund for di final in London.

Bellingham comot di German team for Madrid afta dem pay £88.5m for am in June 2023 and im get chance to help Real Madrid collect double trophies afta dis season aft aim help dem win di La Liga.

Vinicius Jr still dey hot for dis season and im impact for di Real Madrid team still dey very relevant as im dey play like machine.

For di first leg, na Vinicius score di equaliser wey make Madrid draw 2-2 wit Bayern.

Sadly for Kane, im hope for Champions League final wit Bayern end afta dem substitute am.

Thomas Tuchel substitute Kane for di 85th minute against Real Madrid and at dat point, Bayern still dey protect a one-goal lead.

But di lead no last for dem.

Real Madrid need to find a hero – and dem get an unlikely one wit Joselu wey send dem to di final.

Di 34-year-old, wey don play wit Stoke City and Newcastle United without any inspiring outing bin come one for di 81st minute and create magic wit two goals.

Who go don think say player wey come from substitute go send Madrid go final wen dem dey a goal down.

Real Madrid boss Carlo Ancelotti wey don reach im his sixth Champions League final as a manager, say im go enjoy di week.

Source