Didier Drogba: FIF reject Ivorian footballer candidacy to be Ivory Coast FA president

Didier Drogba

Getty Images

Di electoral commission of Ivory Coast football federation don reject former Ivorian international footballer, Didier Drogba as presidential candidate.

Dis announcement dey come afta dem release di list of accepted candidates and di Ivorian footballer name no dey dia.

Didier Drogba, wey bin dey struggle to meet di requirement for di number of sponsorships finally dey successful to submit im candidacy afta many attempts.

Di former Chelsea player say im wan contribute to di rebirth of Ivorian football as tins no dey go well for di organisation.

Di electoral commission accept di candidacy of Yacine Idriss Diallo,wey be former 3rd vice-president of di FIF, di current vice-president of di Federation and president of di League Sory Diabaté.

Didier Drogba get five days to appeal.

Di former captain of di Ivorian Elephants bin suffer one heavy blow for mid-July, wen diAssociation of Ivorian footballers (AFI) no gree sponsor am.

Then, di International Federation of Professional Footballers Associations (Fifpro) suspend AFI say dem no “follow wit wetin dey di books ” afta dem refuse to support Didier Drogba’s candidacy for di head of di FIF.

Didier Drogba later succeed to get eight sponsorships and di support of one of di five interest groups wey dey necessary to apply for di election.

“No be to just become di president of di FIF , I dey afta, but na di mission wey dey bind how e dey function,” di 41-year-old athlete tok.

“Our football no dey go well (…) we dey committed to contribute to how dem go reborn di Ivorian football,” di player wey don hang im boots since di end of 2018 add am.

“I don come back and I dey determined to contribute my stone to di building, to di renewal and to di development of Ivorian football,” he add am.

He also believe say e dey very important for am to give back to Ivorian football, everything dem don give am.