Di Ghana 2024 elections registration wey dey target 623,000 new voters

Applicants gatz to provide dia national ID card for di registration

BBC

Wit seven months to di general elections for Ghana, di electoral commission don begin one limited registration exercise to capture pipo wey just turn 18 years.

For dis exercise wey go last for 21 days, di electoral commission dey target oda pipo wey no fit register in di previous exercises.

For dis registration, dem go do am inside 1,053 centres, wit 268 district officers.

Di commission also dey target 785 additional centres inside areas wey dey “hard to reach”.

Di registration wey begin on Monday, 7 May dey target to register 623,000 by 27 May.

Chairperson of di electoral commission, Jean Mensa tok for press conference say di 2021 population census don estimate say 450,000 pipo don dey turn 18 every year.

“Di commission now project say 1.8million pipo gatz to register from 2021 till now.”

Jean Mensa add say “wen we do di limited registration in 2020, we target 700,000 pipo but by di time we finish, we don register 910,000 pipo. Dis mean say 890,000 pipo don remain.”

“We dey target 70 percent of di remaining 890,000 pipo, but if all of dem show up, di commission go register dem,” di chairperson tok.

Di EC also warn say make underage pipo no partake for dis process.

Sake of di exercise be for pipo wia just turn 18 years, di Ghana education service don direct all students wey dey senior high schools, to participate for dis process.

Di education service don grant all students wey be 18 years, 4-day break wey dey start from 7 May to 10 May, to go to dia electoral area to register

Steps wey pesin gatz to go thru to register to vote

Dis limited registration dey target to register ova 630,000 voters ahead of di December vote

BBC

According to di electoral commission of Ghana, pipo sabi go through four steps.

Step 1 – pesin gatz to present valid national ID card to di registration center wey dey your electoral area.

Di acceptable forms of identification be national identity card and di passport.

If pesin no get any of di two IDs, di applicant must submit one completed identification guarantee form wey two pipo already registered voters don endorse.

Step 2 – Di applicant for provide dia name, age, sex, residential address and oda information for di completion of di registration form.

Step 3 – afta di application don fill di forms, dem gatz submit di data entry clerk wey im too go capture dia biometric details and dia photograph

Step 4 – di registration official go issue one laminated voters ID card wit a receipt wey dey acknowledge di registration.

Di voter must to present dis voter ID card on di day of election for identification.

So far, pipo don dey complain about challenges wit di registration process.

Na so, di commission direct all district officers to “switch to di offline mode of registration beginning 9 May.”

Inside one press release by di electoral commission, dem tok say “dis challenge don delay di process for some places, but we go ensure any backlog of voters by di end of di 21-day process.”

Political parties dey ensure say pipo dey register.

Di major parties for di kontri, di ruling new patriotic party (NPP) and di opposition national democratic congress (NDC) don dey carry pipo to dis centres to register.

2023 voter registration update

According to di data by di electoral commission, di current register get ova 17 million voters.

Afta dis limited registration exercise, di numbers fit to rise to almost 18 million.

Di number of polling stations na 33,367 wey di voting stations proper be 38,622.

Di commission also dey recognize 23 political parties wey participate for di last electoral process.

Source